10
Israel Win Amalek
Adoni-Zedek wey bi Jerusalem king hear how Joshua take enter Ai town kon distroy am and en king, just as e do to Jeriko and en king. E still hear how Gibeon pipol make peace with Israel pipol kon dey stay togeda. Evribody for Jerusalem dey fear, bikos Gibeon na big town, like one of di kings town. E big pass Ai and all en men dem get pawa. So king Adoni-Zedek for Jerusalem kon send message go meet King Hoham for Hebron, King Piram for Jarmut, King Jafia for Lakish and King Debir for Eglon: sey, “Make una kom help mi go fight Gibeon, bikos e don go make peace with Joshua and Israel pipol.”
So di five kings wey kom from Jerusalem, Hebron, Jarmut, Lakish and Eglon, with all dia sojas kon gada go fight Gibeon pipol. Di men for Gibeon kon send message go meet Joshua for en kamp for Gilgal sey, “Make yu nor leave us wey bi yor savants! Make yu kom save us! Bikos all Amor pipol kings wey dey di kountries for hill don kom attack us.”
So Joshua, en sojas and di ones wey get heart well-well kon from Gilgal mash go Gibeon. God tell Joshua, “Make una nor fear, bikos I dey give dem to una. Non of dem go fit stop una.”
Joshua attack dem by sopraiz afta dem use one full nite mash kom from Gilgal. 10 God make dem fear as dem si Israel pipol. Israel pipol really kill dem for Gibeon der. Israel pipol porshu dem pass Bet-Horon kon dey kill dem until dem rish Azeka and Makkedah. 11 As dem dey run from Israel pipol go di low groun for Bet-Horon, God kon make big-big stone dey fall from sky for dia head go rish Azeka. Dem die well-well and di ones wey di stone kill, many pass doz wey Israel sojas kill.
12 Di day wey God put Amor pipol for Israel pipol hand, dat day Joshua pray to God for Israel pipol front sey:
“Yu sun, make yu stay for where yu dey on-top Gibeon!
And make di moon nor near dis side,
just stay for where yu dey for Aijalon Valley!”
13 Di sun and di moon stand for one place
as Israel pipol kill all dia enemies.
Dem rite dis tins wey happen for Jasha Book (wey mean Raitious Book).
Di sun nor move for di sky centre and e shine for one full day. 14 Dat kind tin neva happen before and e nor happen again. God listin to one man, bikos E fight for en pipol, Israel!
15 Den Joshua and Israel sojas kon go back to di kamp for Gilgal. 16 Di five king run go hide for one hole for Makkedah. 17 So dem tell Joshua, “Wi don si di five kings for di whole where dem hide put for Makkedah.” 18 Joshua ansa, “Make una use big stone kover di hole mout kon put pipol wey go guide am for der. 19 But make una nor stay tey! Make una porshu and katch una enemies! Nor let dem rish dia kountry, bikos di Oga una God go give dem to una.”
20 Joshua and Israel pipol almost kill dem finish, but some still eskape go di main town. 21 Den Israel sojas kom back well kom meet Joshua for di kamp for Makkedah. Nobody even fit tok against Israel pipol for di full land.
22 Joshua sey, “Make una open di hole, den bring di five kings kom meet mi.” 23 Dem do as Joshua tell dem kon take di five kings go meet am and na Jerusalem, Hebron, Jarmut, Lakish and Eglon king. 24 Wen dem bring di kings kom meet Joshua, e koll Israel men kon tell di sojas oga wey dey with am sey, “Make una kom here kon mash dis kings for dia neck.” So dem kom put dia legs for di kings neck.
25 Den Joshua tell dem, “Make una nor fear or shake. Make una get heart and dey strong, bikos God go do di same tin to all una enemies wey una dey fight against.” 26 Den Joshua kill di kings kon hang dem on-top tree. Dem dey di tree till evening.
27 Wen sun don go down, Joshua kon sey make en men bring di kings body kom down from di tree kon trow dia body inside di hole wey dem hide put before, den pak big-big stones take kover di hole. (Dem still dey der till today.)
Joshua Attack
28 Dat day, Joshua enter Makkedah town kon kill evribody wey dey stay der plus di king. E do di king wetin e do to Jeriko king. 29 Joshua and Israel pipol kon mash from Makkedah go Libnah go fight dem. 30 God give Libnah to Joshua and en sojas and dem kill evribody wey dey stay der; evribody die finish. Dem kon do en king as dem do to Jeriko king.
31 Joshua and en sojas kon mash from Libnah go Lakish. En and en sojas kon fight against Lakish 32 and God make dem win and dem enter di whole town for di sekond day. Dem kill evribody wey dey stay der, just as dem do for Libnah. 33 Den, Horam wey bi king for Geza kon kom help Lakish, but Joshua kill en and all en sojas finish.
34 Joshua and all Israel pipol mash from Lakish go Eglon. En and all en sojas kon fight dem. 35 Dat day, dem enter di town kon kill evribody wey dey stay der, den distroy am, just as dem do to Lakish.
36 Joshua and all en sojas mash from Eglon go Hebron go fight. 37 Dem enter di town kon kill di king, evribody wey dey stay der and di towns wey dey near der and dem nor leave anybody. Dem kill evribody, just as dem do for Eglon.
38 Joshua and en sojas kon go fight against Debir. 39 Dem enter di town, katch di king and all di towns wey dey near am, den dem kill evribody wey dey stay der; nobody survive. Dem kill evribody, just as dem do for Hebron, Libnah and to dia kings.
40 Joshua win di whole land plus di kountries for hill, for di Negev, di lowland, di slope and all dia kings. E nor let any one live. E kill evritin wey dey breath, just as di Oga wey bi Israel God, tok. 41 Joshua win di aria wey dey between Kadesh Barnea and Gaza, plus evriwhere for Goshen go rish Gibeon. 42 Joshua katch all dis kings and dia land for just one fight, bikos di Oga wey bi Israel God dey fight for en pipol.
43 Den Joshua and all en sojas kon go back to dia kamp for Gilgal.