14
Judah Tribe
Dis na di aria wey priest Eleazar, Joshua wey bi Nun pikin and Israel leaders give Israel pipol for Kanaan land. Di land wey dem give di nine and half tribe, na dice dem trow take divide am, just as God tell Moses. Naw, di land wey dey east for Jordan River, Moses divide am give two and di half tribe, but e nor divide any land give Levi pipol. Dem si Josef shidren as two tribe, Manasseh and Efraim. Dem nor give Levi pipol any land; aldo dem give dem towns where dem go stay, plus fields where dia animals go for dey chop. Wen dem dey divide di land, Israel pipol do as God tell Moses.
Judah men kom meet Joshua for Gilgal and Kaleb wey Jefunneh wey kom from Kenizz born kon tell Joshua sey, “Yu know wetin God tell Moses en savant for Kadesh Barnea about yu and mi. I bi forty years wen Moses, God savant send mi from Kadesh Barnea go spy di land and I kom back kon tell am di trut. Doz wey follow mi kon dey make Israel pipol fear, but I still dey loyal to di Oga my God. Dat day, Moses kon promise mi, ‘Any land wey yu waka enter, go bi yu and yor family own forever, bikos yu dey loyal to di Oga yor God.’
10 “So naw, make yu si, God don keep mi rish naw, just as E promise. For dis forty-five years, even since God tell Moses en word wen Israel pipol still dey di wildaness kom rish naw, I nor die and naw, I bi eighty-five years. 11 Yet, I still strong like wen Moses send mi go spy. I fit still fight kon do my evriday work with di same pawa wey I get dat time. 12 So make yu give mi di kountry for hill wey God promise mi dat time! Dat time, yu know sey na Anak pipol dey der with dia big-big towns. But if God dey with mi, I go distroy dem, as God promise.”
13 Den Joshua bless Kaleb, Jefunneh pikin kon give Hebron land to am. 14 So till today, Kaleb wey en papa na Jefunneh from Kenizz kon take Hebron land, bikos e dey loyal to God. 15 (Before-before, dem dey koll Hebron, Kiriat-Arba. Na Arba bi Anak pipol papa and evribody know am.)
So afta dis time, war nor kon dey di land again.