18
How Dem Divide Di Land
Israel pipol gada for Shiloh and dem kon build di tent where dem for dey meet, for der. Aldo dem don win di land, dem neva still give seven tribe for Israel dia own share for di land.
So Joshua tell Israel pipol: “Na how many years una won wait before una start to stay all dis land wey una Oga God for Israel don give una? Make una selet three-three men from each tribe. I go ask dem make dem waka round di land kon draw di map for mi. Den I go divide am into seven. Judah go stay for di sout-side and Josef family go dey nort. But as for una, make una divide di land into seven, den bring am kom meet mi. I go trow dice before di Oga awa God. But Levi pipol nor go get any land among una, bikos dia propaty na to serve God. Gad, Reuben and half for Manasseh tribe don already take dia part for Jordan River east wey Moses give dem.”
Wen di men kom out, Joshua kon tell doz wey dey go look di land sey, “Make una go waka round di land kon put am for map, den una go kom back kom meet mi, so dat I go trow dice for una for God present as wi dey Shiloh.” Di men waka round di land kon divide am into seven for di book. Den dem kom back kom meet Joshua for di kamp for Shiloh. 10 For der, Joshua kon trow dice for God present kon divide di land among Israel pipol just as e suppose to bi.
Benjamin Tribe Land
11 Di first dice wey Joshua trow na for Benjamin tribe akordin to dia family. Dia land na between Judah and Josef tribe.
12 Di borda for nort start for Jordan River go rish Jeriko for nort, den e go di west side for di hill kountry go rish di desert for Bet-Aven. 13 E cross from der go Luz kon go di sout for Luz (wey bi Bethel), den e go Atarot-Addar for di hill wey dey sout for di low side for Bet-Horon.
14 E turn from di west side face sout from di hill wey dey near Bet-Horon for di sout till e rish Kiriat-Baal (wey bi Kiriat-Jearim), di town wey bi Judah tribe own. Dis na di borda for west.
15 Di sout-side start for Kiriat-Jearim kon go west for Neftoah wotaside. 16 Di borda go di hill kountry near Ben-Hinnom Valley wey dey Refah Valley for nort. E from Hinnom Valley go di low land for Jebus aria for sout, den kon go En-Rogel. 17 E go En-Shemesh nort and Gelilot opposite Adummim Pass, den kon go Reuben pikin, Bohan Stone. 18 E from der cross go di lowland for front of Arabah for nort go rish di main Arabah. 19 E cross go di lowland for Bet-Hoglah for nort kon end for di nort side for di Salt Sea for Jordan River side. Dis na di borda for sout.
20 Jordan River borda dey for east.
Dis na di borda for di land wey dem give Benjamin tribe and en family.
21 Dis na di towns wey bilong to Benjamin tribe and family:
Jeriko, Bet-Hoglah, Emek-Kezizz, 22 Bet-Arabah, Zemaraim, Bethel, 23 Avvim, Parah, Ofrah, 24 Kefar Ammoni, Ofni and Gibeah. Dem bi twelf big and small-small towns.
25 Gibeon, Rama, Beerot, 26 Mizpa, Kefirah, Mozah, 27 Rekem, Irpeel, Taralah, 28 Zela, Haelef, Jebus pipol town (wey bi Jerusalem), Gibeah and Kiriat. Dem bi fourteen big and small town.
All dis na di land wey Joshua give Benjamin tribe.