2
Joshua Send Pipol Go Spy Jeriko
Joshua kon send two pipol from Shittim kamp go spy Kanaan land especially Jeriko town. Wen dem rish di town, dem kon go sleep for one ashawo house and di ashawo name na Rahab.
Jeriko king hear sey some pipol from Israel don kom spy di town, so e send pipol go tell Rahab sey: “Di pipol wey dey yor house won spy dis town! So make yu bring dem kom out!”
But di woman hide di two men kon ansa, “Yes, dis men really kom my house, but I nor know where dem from kom. Wen time rish to klose di town gate for nite, di men kon go. I nor even know where dem dey go. Make una kwik-kwik porshu dem and una go katch dem!” (Naw, di woman don hide dem for di roof kon put dem under di tins wey dey der.) Di king men kon find di men go di road where dem dey pass go Jordan River. As dem just kom out bigin porshu di men, di gateman kon lock di town gate.
So before di two spy go sleep, Rahab klimb go meet dem for di roof kon tell dem, “I know sey God go give una dis town. Wi dey fear una well-well and evribody wey dey stay di town dey shake bikos of una. 10 Bikos wi hear as God dry di Red Sea for una wen una komot from Egypt and how una handle di two Amor kings wey bi Sihon and Og, for di oda side for Jordan River. 11 Wen wi hear di news, fear katch us and wi kon dey tink sey wi go die wons wi si una. Bikos di Oga wey bi una God, na God for heaven, eart and evritin wey dey under di eart! 12 So make una promise and swear with God name sey, bikos I dey good to una, una go dey good to mi and my family. Make una promise sey 13 una nor go kill my papa, mama, brodas, sistas and evritin wey bi my own.”
14 Di men kon tell am, “Wi swear with awa life sey, nor-tin go happen to yu! If yu nor tell anybody wetin wi kon do for here and God give us dis town, wi go sorry for yu and evritin wey bi yor own.”
15 Den Rahab use rope take drop dem thru window. (Dem build Rahab house join di wall for di town and na der e dey stay.) 16 Rahab tell dem, “Make una run go di kountry for di hill, so dat who dey porshu una nor go si una and make una stay der for three days. By dat time, pipol wey dey porshu una go don kom back, den una fit go una own.”
17 Di men kon tell am, “Di promise wey wi promise nor go do us anytin unless sey yu do as wi sey make yu do: 18 Wen wi attack dis land, make yu tie dis red rope for di window wey yu for allow us kom down, den go pak all yor family enter yor house and evribody where dey stay yor papa house. 19 Anybody wey kom out from yor house, na-im kill ensef bi dat, so dat one nor go bi awa fault! But if anytin happen to anybody inside yor house, den make yu blame us. 20 But if yu tok wetin wi kom do for here, di swear wey wi swear, don skata bi dat.”
21 Rahab kon sey, “I gri with evritin wey una tok.” E tell dem where dem go pass kon tie di red rope for di window.
22 Dem go di kountry for di hill kon stay der for three days and all di pipol wey dey porshu dem, kon go back. Jeriko men look evriwhere, but dem nor si dem. 23 Den di two men kom down from di hill, cross di river go meet Joshua wey bi Nun pikin kon tell am evritin wey dem don si and know. 24 Dem tell Joshua, “True-true, God don really give us di land, bikos evribody wey dey stay di land dey fear us well-well!”