22
Di Tribe For East
Den Joshua koll Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe kon tell dem: “Una don do evritin wey God savant Moses tell una kon obey evritin wey I tell una. All dis time, una neva leave una pipol and una always dey obey di Oga wey bi una God. Naw, di Oga una God don guide una brodas and sistas, just as E promise dem. So make una go back to una house wey Moses, God savant divide give una for Jordan River east. But make una dey obey God kommand and laws wey en savant Moses tell una with kare; make una dey loyal to am kon serve am with all una heart and body!”
Joshua give dem gift kon tell dem make dem go back to dia house. (Naw, Moses give Bashan land to half of Manasseh tribe and Joshua kon give Jordan River west to di oda half for Manasseh tribe and Israel pipol wey dey with dem.) Wen Joshua sey make dem dey go house, e give dem gift kon sey, “Make una take dis tin dey go and dem bi plenty money, many-many animals, silva, gold, bronze, iron and many klot. Di tins wey wi karry from awa enemies, make una divide am among unasef.”
So Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe kon leave Israel pipol for Shiloh wey dey Kanaan, den dem go dia own house for Gilead wey God give dem thru Moses.
No More War
10 Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe rish Gelilot near Jordan River for Kanaan land kon build one fine altar for der. 11 Israel pipol hear wetin happen sey: “Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe don build one altar for di town door-mot for Gelilot wey dey Kanaan near Jordan River for di oda side wey Israel pipol dey.” 12 Wen Israel pipol hear wetin happen, dem kon gada for one place for Shiloh to go fight dem.
13 Israel pipol send Finehas, wey bi Eleazar di priest son go Gilead go meet Reuben and Gad pipol plus half of Manasseh tribe. 14 Ten leaders follow am go, one from each tribe, dem bi leaders for Israel family.
15 Dem kon go Gilead land go meet Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe kon tell dem: 16 “Evribody for Israel wey bi God own sey make wi ask una, ‘Wetin make una disobey Israel God as una don turn from am. 17 Di sin wey wi sin for Peor nor bad rish? Till today wi neva fit klean awasef finish; e even bring wahala kom meet us wey bi God pipol. 18 Naw, today, una don turn una back to di Oga una God!
“ ‘Today wey una dey fight against God so; E fit kon vex for di whole Israel pipol. 19 But if una land nor dey okay bikos of sin, una fit cross kom meet us for di land where God dey. But make una nor build altar for unasef wey nor bi awa Oga God altar, bikos dat go show sey una dey fight against God and wi. 20 Wen Zera pikin, Akan nor gri obey di kommand about di town tins, na di whole town sofa am, even doh na only one man sin. And nor bi only en die for di sin wey e kommit.’ ”
21 Den Reuben and Gad pipol and half of Manasseh tribe kon ansa Israel leaders sey: 22 “Di Oga God, na-im strong pass oda gods! Di Oga God, na-im strong pass oda gods! Na-im know di trut and Israel pipol must know di trut too. If wi don sin or disobey God, make una nor sorry for us today! 23 If wi build altar for awasef kon turn from God as wi dey make ofrin and sakrifice on-top am or dey offa ofrin of peace for awasef, make God ensef ponish us.
24 “Wi swear sey wetin make us do like dis na, bikos wi dey fear sey tumoro una shidren-shidren fit dey ask awa shidren-shidren sey, ‘Who give una di rite to woship di Oga wey bi Israel God? 25 Na God make Jordan River as boundary between wi and una (Reuben and Gad tribe). So una nor get rite to woship God.’ And if e happen like dat, una shidren-shidren fit make awa own stop to woship and obey God.
Altar to Remember God
26 “So wi kon agri sey make wi build dis altar, nor bi to burn ofrin or to sakrifice put, 27 but na to remind us and una and awa shidren-shidren sey, wi go woship God for en present with burn ofrin, sakrifice and peace ofrin. Den, tumoro una shidren-shidren nor go fit tell awa own sey, ‘Una nor get rite to woship God.’
28 “Wi kon sey, ‘If dem tell us or awa shidren-shidren dis kind tin tumoro, wi go ansa dem sey, “Si di fine altar wey awa grand-grand papa build for God, nor bi for burn ofrin or sakrifice, but na to dey remind wi and una.” ’
29 “Wi nor go ever disobey God and wi nor go fit turn back from God kon build altar wey wi go dey burn ofrin or do sakrifice put, apart from di altar wey dey awa Oga God Temple!”
30 Wen Finehas wey bi priest, di kommunity and di family leaders wey kom with am hear wetin Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe tok, body kon sweet dem well-well. 31 Finehas wey bi Eleazar pikin and di priest kon tell Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe sey, “Today wi don know sey God dey among us, bikos una neva disobey God at-all. Naw, una don save all Israel pipol from God vexnashon.”
32 Finehas wey bi Eleazar pikin, di priest and di leaders kon leave Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe for Gilead town kon go ripot give di whole Israel wey dey Shiloh for Kanaan land. 33 Wen dem tell Israel pipol evritin, belle sweet dem and dem kon tank God. Dem nor ever tok again sey dem go distroy Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe.
34 Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe kon name di altar and sey, “Really e go dey remind us sey na di Oga bi God.”