11
Klean And Unklean Animal
God tell Moses and Aaron, “Make una tell Israel pipol sey: ‘Among all di animal wey dey di land, dis na di ones wey una fit chop. Una fit chop animal wey get two toes and dey re-shop grass wey e don swallow. But make una nor chop animal wey dey re-shop grass but nor get two toes: Kamel nor dey klean, bikos e dey re-shop grass, but e nor get two toes. Doz animals wey dey stay for rock nor dey klean, bikos dem dey chop dia vomit, even doh dem nor get two toes. Hare nor dey klean, bikos e dey chop en vomit, even doh e nor get two toes. Pig nor dey klean, bikos e get two toes, but e nor dey chop en vomit. Make una nor chop dis meat or tosh dia dead body; bikos dem nor dey klean.
Klean And Unklean Animal For Wota
“ ‘Dis na di animal for wota wey una fit chop: Any animal wey get both fin and skale, weda e dey sea or river. 10 But make una nor chop anytin for wota wey nor get fin or skale. 11 Since una dey forbid am, make una nor chop dia meat or tosh dia dead body. 12 Any animal for wota wey nor get fin and skale, make una nor chop or tosh en dead body.
Klean Or Unklean Bird
13 “ ‘Dis na di bird wey una nor suppose chop. Make una nor ever chop any kind vulture, 14 kite, buzzard, 15 crow, 16 di eagle owl, owl wey en ear short or long, any kind hawk, 17 small owl, kormorant, great owl, 18 white owl, owl for wildaness, Egypt owl, 19 stork, any kind heron, hoopoe and bat.
Klean Or Unklean Insect
20 “ ‘All di insect wey get feada nor dey klean, dem nor dey good for una. 21 But una fit chop insect wey get four leg and dey jump for land. 22 Una fit chop lokust, cricket and grasshoppa. 23 But all di oda animal for groun wey get feada nor dey good for una.
Dead Animals
24 “ ‘Anybody wey tosh unklean animal dead body don spoil ensef and dat pesin go dey unklean till evening. 25 Anybody wey karry dia dead body, go-go wosh en klot and e go dey unklean till evening.
Unklean Animals
26 “ ‘All di animal wey get toe wey nor divide into two finish and dem nor dey re-shop dia food, dey unklean to una. Anybody wey tosh dem don dey unklean. 27 All di animal wey dey waka with four legs, doz wey get finger, dey unklean to una. Anybody wey tosh dia dead body go dey unklean till evening 28 and di pesin wey karry dia body, go-go wosh en klot, but e go dey unklean till evening. Dis animals nor dey good for una.
Animals Wey Dey Creep For Groun
29 “ ‘Naw, dis na di tins wey dey unklean among di animal wey dey stay land: rat, any kind big lizard, 30 krokrodie, lizard wey get spot for body, wall-deko for house and kameleon wey en kolour dey shange. 31 Dis na di ones wey dey unklean among di animals for land. Anybody wey tosh dia dead body go dey unklean till evening. 32 Anytin wey dem fall put wen dem die go dey unklean; weda na wood, klot, leda or sak. Doz tins nor dey yuzful again. Even wen dem deep am for wota, e go still dey unklean till evening.
33 “ ‘And if dia body fall inside pot wey bi klay, evritin wey dey inside di pot go dey unklean and una must break di pot. 34 If di wota from di pot tosh any food wey una suppose chop or wota wey una won drink, den evritin don dey unklean. 35 Anytin wey dia dead body fall put go dey unklean. Weda na stove or oven, dem go break am to pieces.
36 “ ‘Wota wey dem fetch from spring dey klean, but if dia dead body tosh di pot, e go dey unklean. 37 If any one fall for any seed wey dem won plant, dem go plant am and e go dey klean. 38 But if dem put wota for di seed and one dead body fall put, e go dey unklean.
Klean Animal For Land
39 “ ‘If any animal wey yu suppose chop die on en own, anybody wey tosh en dead body go dey unklean till evening. 40 If anybody chop any part for di animal, e must wosh en klot, but e nor go still dey klean till evening. Anybody wey karry di dead body must wosh en klot, but e go dey unklean till evening.
41 “ ‘Una must nor chop any animal wey dey creep for groun, 42 weda dem dey creep or waka with four leg or dem get many legs. 43 If una chop any of dis animals, una nor go dey klean. 44 I bi di Oga una God and una go make unasef pure kon dey holy, bikos I dey holy. Una must nor dirty unasef. 45 Na mi bi God wey take una komot from Egypt, so dat I go bi una God and una go dey holy, bikos I dey holy.
46 “ ‘Dis na di law for di animal wey dey land; di birds, all di animals for wota and doz ones wey dey creep for land. 47 And dis law na to separate between wetin dey klean and wetin nor dey klean, so dat pipol go know di animals wey dem suppose chop and di ones wey dem nor go chop.’ ”