16
Di Day To Beg
God tell Moses afta Aaron sons don die bikos dem offa strenj fire to God: “Make yu tell yor broda Aaron sey, na di rite time e go-go di place wey holy well-well for di curtain back, bikos na for der I appear for kloud on-top di Kovenant Box. If e nor do am, e go die.
Ofrin For Dat Day
“E go fit enter di place wey holy well-well only afta e don bring one yong melu for sin ofrin and one ram for burnt ofrin. Before Aaron go enter di place wey holy pass, e must baf and wear di garment wey priests dey wear; wey bi linen robe and short nika, both di belt and di priest kap. Israel pipol go give Aaron two man goat for sin ofrin and one ram for burnt ofrin.
“E go give one melu as sakrifice make God for forgive en and en family dia sins. Den e go take di two goat go di door-mot for di tent where dem for dey do meetin. E go trow dice kon mark one goat sey, ‘Dis one go bi ofrin to God’ and di oda goat go karry di pipol sin go Azazel wildaness. Aaron go sakrifice di goat wey dem choose thru di dice wey dem trow kon gi-am as sin ofrin. 10 Dem go give di life goat wey dem choose for Azazel to God kon send am komot go Azazel for di wildaness, so dat God go forgive di pipol dia sin.
How To Do Sin Ofrin
11 “Wen Aaron sakrifice di melu as sin ofrin for ensef and en family, 12 e go take fire pan with plenty shako from di altar kon pak fine incense full hand, den e go take am go di place wey holy well-well. 13 For God present, e go put di incense for fire and di smoke wey dey kom out from di incense go kover di Kovenant Box make e for nor si am kon die. 14 E go take some of di melu blood with en finger kon go sprinkol am for di east side for di forgivenes plate, den e go rub am seven times for di Kovenant Box front.
15 “Afta dat one, e go kill di goat for di sin ofrin for di pipol, take di blood go di place wey holy pass kon rub am for di plate and di Kovenant box front, just as e do di melu blood. 16 Na like so e go take do sakrifice for di Holy Place for Israel pipol sin. E go still do sakrifice for di tent, bikos di tent dey centre for di kamp even as dem nor dey holy. 17 From di time wey Aaron enter di place wey holy well-well go do di sakrifice, go rish wen e go kom out, nobody must dey inside di tent. Wen e don do sakrifice for ensef, en family and di whole kommunity, 18 den e must go di altar wey dey before God kon santify am. E must take some of di melu and goat blood kon put am for front for di altar korna. 19 E must use en finger take rub some of di blood for di altar seven times. Na so e go take santify di altar from Israel pipol sin, so dat dem go dey holy.
How To Do Di Goat Sakrifice
20 “Wen Aaron don do di sakrifice to take santify di place wey holy well-well, where dem for dey do meetin and di altar, e go give God di goat wey still dey alive wey dem choose for Azazel. 21 E go put en two hand for di goat head kon konfess all Israel pipol evil, sin and sturbones for di goat head, den drive am go di wildaness. 22 Di goat go karry all dia sin go anoda land wey pipol nor dey.
Konklusion
23 “Den Aaron go-go di tent, komot di priest garment wey e wear before e enter di place wey holy well-well kon leave dem for der. 24 E must baf for di holy place kon wear en own klot. Afta dat, e go komot go give di burnt ofrin for en and di pipol sin. 25 Di animal fat for di sin ofrin, e go burn am for di altar.
26 “Di man wey drive di goat go Azazel for di wildaness, must wosh en klot and baf, before e go kom back to di kamp.
27 “Di melu and di goat wey dem use for di sin ofrin, so dat Israel pipol go dey klean from sin, dem go karry dia blood go di place wey holy pass kon burn dem for outside. Dem go burn dia skin, meat and intestine. 28 Di pesin wey burn dem go wosh en klot kon baf before e go-go back to di kamp.
Remember Dat Day
29 “Dis na di law wey una go obey forever. For di tent day for di sevent mont, Israel pipol and di strenjas wey dey stay with dem must fast and dem must nor do any work. 30 For dat day, dem go do sakrifice, so dat una go dey klean for God eye. 31 Dat day go dey very holy, dem go fast and dem nor go do any work at-all. Dem go keep dis law forever. 32 Di priest wey dem choose as High Priest to serve wen en papa nor dey, na-im go do di sakrifice. E go wear di priest garment 33 kon santify di place wey holy well-well, where dem for dey do meetin, di altar, di priests and all di pipol for Israel. 34 Dis na di law wey una go obey forever. Dem must do dis sakrifice wons for evry year to take santify Israel pipol from all dia sins.”
So Moses do as God kommand am.