18
To Dey Obey God
God tell Moses: “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Na mi bi di Oga una God. Make una nor do wetin una do for Egypt where una dey before or for Kanaan land wey I go soon give una or do wetin dia law tok. Una must always keep my law and do wetin I tok. Na mi bi di Oga una God. So una must keep my law and kommandment; anybody wey do like dat, go get long life. Na mi bi God.
Law About Sex
“ ‘Make nobody sleep with en family memba, bikos na mi bi God. Make una nor sleep with una mama, bikos una don disgrace una papa bi dat. Di woman na yor mama, so yu must nor sleep with am. Make una nor go sleep with una papa wife, bikos na una papa nakednes.
“ ‘Make una nor go sleep with una sista, weda na una papa or mama pikin; or weda dem born am for di same house or outside; una must not sleep with dem.
10 “ ‘Make una nor sleep with una grand-pikin, weda di girl na yor son pikin or yor dota pikin, bikos dis go make yu disgrace yorsef. 11 Make una nor sleep with una step sista, or di girl pikin wey una papa wife born, bikos di girl na yor sista. 12 Make una nor sleep with una papa sista; bikos na yor papa flesh, e bi. 13 Make una nor sleep with una mama sista, bikos na yor mama flesh, e bi. 14 Make una nor sleep with una papa broda wife kon disgrace di man, bikos di woman na una aunty. 15 Make una nor sleep with una pikin wife; bikos na una pikin wife e bi. 16 Make una nor sleep with una broda wife, bikos una go disgrace una broda.
17 “ ‘Make una nor sleep with both mama and dota. And make una nor sleep with di woman grand-pikin, weda na en son or dota born am. Dem bi klose family and dis tin dey wiked well-well.
18 “ ‘As long as yor wife dey alive, nor marry en sista as sekond wife kon sleep with am, bikos dem go hate demsef.
19 “ ‘Make una nor sleep with any woman wey dey mestrate.
20 “ ‘Make una nor sleep with anoda man wife, bikos e nor good and e go make una dey unklean.
21 “ ‘Make una nor give una pikin as ofrin to Molek juju, bikos e go disgrace Oga God name.
22 “ ‘Make man nor sleep with man as if na woman; bikos dat kind tin dey bad for God eye.
23 “ ‘No man or woman must sleep with any animal, bikos e go make dem dey unklean.
Warnin About Kanaan Pipol
24 “ ‘Make una nor spoil unasef with dis tins, bikos di pipol wey I dey drive komot for una, don spoil demsef with all dis tins. 25 Di whole land don dey unklean and I don ponish dem for dia sin, so di land don rijet di pipol wey dey stay der. 26 Una must obey all my law and kommand and una nor go do dis evil tins, both Israel pipol and doz wey bi strenjas, 27 bikos di pipol wey dey di land before, don do all dis evil tins and di land don dey unklean. 28 Make una nor make di land rijet una, bikos una spoil am, just as e rijet di pipol wey dey der before. 29 If anybody do dis evil tin, di pesin wey do dem nor go dey among my pipol again. 30 Una must obey my kommand and nor do any evil wey dem do before, so dat una nor go spoil unasef with dem. Na mi bi di Oga una God.’ ”