4
Sin Ofrin
God kommand Moses, “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Dis na how una go trit anybody wey break God kommand by mistake.
For Priest
“ ‘If na di High Priest sin kon make di pipol dey guilty, e go give one yong melu wey dey okay to God for en sin. E go take di melu go di tent gate, put en hand for di melu head kon kill-am for God present. Den di High Priest go take some of di melu blood kon karry am enter di tent. E go shuk en finger for di blood kon sprinkol am seven times for di holy curtain front. Den e go put some of di blood for di horn for di incense altar wey dey di tent. E go pour di blood wey remain under di altar wey dem dey use take dey burn ofrin, wey dey di tent gate. E go take all di fat from di sin ofrin melu, plus di fat wey dey di intestine; di two kidney and dia fat and di part for di liver wey good well-well. 10 Di priest go take dis fat kon burn am for di altar wey dem dey use for burnt ofrin, just as e dey do for any animal wey dem kill for di peace ofrin. 11 But e go take di skin, all di flesh, leg and intestine 12 den karry dem go outside di kamp for where dem dey pour ash put, den e go burn dem for der with firewood.
Di Whole Israel
13 “ ‘If na Israel pipol kommit sin by mistake kon break one of God kommand and dem nor know, dem still don sin bi dat. 14 But wen dem know sey dem sin, di pipol must bring one yong melu take do sin ofrin. Dem go bring am kom di tent where dem for dey do meetin. 15 Di leaders go put dia hand for di melu head kon kill-am for der for God present. 16 Di High Priest go take some of di melu blood go inside di tent. 17 E go shuk en finger for di blood kon sprinkol am seven times for di holy curtain front. 18 Den e go put some blood for di horn for di incense altar wey dey di tent. E go pour di blood wey remain for under di altar wey dem dey use take dey burnt sakrifice wey dey di tent gate. 19 Den e go take all di fat kon burn dem for di altar. 20 E go do di same tin with dis melu as e bin do with di melu wey dem use for di High Priest sin ofrin. Na so e go take sakrifice for di pipol and God go forgive dem. 21 E go karry di melu go outside di kamp go burn am, just as e take burn di melu wey e give for en own sin.
Di Leaders
22 “ ‘If one among Israel leaders sin kon break God kommand by mistake, 23 den as e just know sey e sin, e must bring woman goat wey dey okay as en ofrin. 24 E go put en hand for di animal head kon kill-am for di nort side for di altar, where dem for dey kill animals for burnt ofrin. Dis na di ofrin wey dey remove sin from pesin body. 25 Di priest go shuk en hand inside di animal blood kon put am for di horn for di altar wey dem dey use for burnt ofrin. Den e go pour di remainin ones under di altar. 26 E go burn all di fat for di altar, just as e take burn di fat for di animal wey dem kill take do peace ofrin. Na so di priest go take do di sakrifice for di leader wey sin and God go forgi-am.
Ordinary Pesin
27 “ ‘If na ordinary pesin sin kon break God kommand by mistake, 28 den as e just know sey e sin, e go bring woman goat wey dey okay as en ofrin. 29 E go put en hand for di animal head kon kill-am for di nort side for di altar, where dem for dey kill animals for burnt ofrin. 30 Di priest go shuk en hand inside di animal blood kon put am for di horn for di altar wey dem dey use for burnt ofrin. Den e go pour di remainin ones under di altar. 31 E go remove all di fat, just as e do with di fat for di peace ofrin. E go burn am for di altar with di food ofrin wey dem give God. As di priest give dis sakrifice, God go forgive di man.
32 “ ‘If e bring sheep as en sin ofrin, e must bi woman own wey dey okay. 33 E go put en hand for di animal head kon kill-am for di nort side for di altar, where dem for dey kill animals for burnt ofrin. 34 Di priest go shuk en hand inside di animal blood kon put am for di horn for di altar wey dem dey use for burnt ofrin. Den e go pour di remainin ones under di altar. 35 E go remove all di fat, just as e do with di fat for di peace ofrin. E go burn am for di altar with di food ofrin wey dem give God. As di priest give dis sakrifice, God go forgive di man.