9
Woship For Di Tabanako
For di eight day, Moses koll Aaron and en sons and di leaders for Israel kon tell Aaron, “Make yu take one yong melu and one ram wey dey okay kon give dem to God. Di melu go bi for sin ofrin, while di ram na for burnt ofrin. Den yu go tell Israel pipol sey, ‘Make dem take one goat for sin ofrin, one melu and one lamb wey bi one year wey dey okay kon use dem as burnt ofrin, den dem go take one melu and ram for peace ofrin. Dem go sakrifice dem give God with di korn ofrin wey dem mix with olive oil. Dem must do am, bikos God go appear to dem today.’ ”
So dem take evritin wey Moses kommand go di tent front and di whole kommunity gada for der kon woship God. Den Moses tell dem, “Dis na wetin God kommand una to do, so dat di lite wey dey shine for en present, go appear to una.”
Den Moses tell Aaron, “Make yu go di altar go offa di sin ofrin and di burnt ofrin, so dat God go forgive una and di pipol. Make yu do di ofrin for di pipol, so dat God go forgive una just as E don kommand.”
Sin Ofrin For Di Priests
Aaron go di altar kon kill di yong melu for en own sin ofrin. En sons karry di blood gi-am, den e shuk en finger put kon put am for di horn wey dey di altar and e pour di remainin ones under di altar. 10 E burn di fat for di altar, di two kidney and dia fat and di best part for di liver, just as God kommand Moses. 11 But e burn di meat and di skin for outside di kamp.
Burnt Ofrin For Di Priests
12 E kill di animal wey dem won use for burnt ofrin. En sons karry di blood gi-am and e rub am for di four side for di altar. 13 Dem give Aaron di head and di oda pieces for di animal and e burn dem for di altar. 14 E wosh di intestine and di leg kon burn dem for di altar on-top di remainin burnt ofrin.
Ofrin For Di Pipol
15 Afta, e kon do ofrin for di pipol. E take di goat wey dem give for di pipol sin kon kill-am and e first do en own sin ofrin. 16 E still bring di animal for di burnt ofrin kon gi-am akordin to di law. 17 E give di korn ofrin; pak flower full en hand kon burn am for di altar. (Dem go dey add dis one join di burnt ofrin evriday.)
18 E kill di melu and di ram as peace ofrin for di pipol. En sons karry di blood gi-am and e rub am for di four side for di altar. 19 Aaron put di melu fat and di ram 20 on-top di animal breast kon karry all go di altar. E burn di fat for di altar 21 kon give di breast and di rite leg as special gift to God for di priests, just as Moses kommand.
22 So, Aaron bless di pipol wen e don finish all di sakrifice. 23 Moses and Aaron enter di tent and wen dem kom out, dem kon bless di pipol, den di lite wey dey shine for God present kon appear to di pipol. 24 At wons, God send fire go burn di burnt ofrin and di fat dem for di altar. Wen di pipol si am, dem kon shaut and bow face groun.