18
Who Big Pass For God Kingdom
Dat time, di disciples kon ask Jesus, “Na who big pass for God Kingdom?”
Jesus kon koll one pikin stand for dia front, den e ansa, “I tell una true word, unless una bi like small pikin, una nor go fit enter God Kingdom! Anybody wey bring ensef down like dis small pikin, naim big pass for God Kingdom.
“Anybody wey welkom one pikin like dis one for my name, welkom mi. But if pesin make one of dis small shidren wey bilive mi kommit sin, e betta make dem tie grindin stone for en neck, make e for sink inside river.
“Wahala dey for dis world, bikos of di sin wey pipol dey kommit! Na true sey trobol must kom, but e go bad for di pesin wey go kause di trobol. If yor hand or leg dey make yu sin, make yu kut am trowey. E betta make yu enter God Kingdom without hand or leg, dan sey God trow yu inside fire wey nor dey kwensh. If yor eye dey make yu sin, make yu pul am trowey. E betta make yu enter God Kingdom with one eye, down sey God trow yu enter hell-fire with two eyes.”
Sheep Wey Lost
10 “Make sure sey una nor porshu any of dis small shidren komot. I tell una di trut, dia angels dey my Papa front for heaven evritime. 11 Bikos Man Pikin kon save pipol wey lost.
12 “Wetin yu tink? If pesin get hundred sheep and one waka lost, e nor go leave di ninty-nine for di bush go find di one wey lost? 13 I tell una true word, wen e si am, e go happy for dat one pass di ninty-nine wey nor lost. 14 Na like dis too yor Papa for heaven nor wont make any of en shidren lost.”
Christian Brodas And Sistas
15 “If yor broda do yu bad, make yu go tell am wetin e do. If e asept wetin yu tell am, yu don win yor broda back bi dat. 16 But if e nor asept wetin yu tok, take one or two pipol follow body go meet am, bikos matter wey two or three pipol tok put, naim betta pass. 17 If e nor asept wetin dem tok, make yu tell di church leaders. If e nor gri listin to wetin di church leaders tok, den make una trit am like sina or tax kollector.
18 “I tell una true word, anytin wey una take prayer tie for eart, God go tie am for heaven and anytin wey una take prayer luz for eart, God go luz am for heaven.
19 “Again, I tell una true word, if two of una for dis world gri and pray for anytin, my Papa for heaven go do am for una. 20 Anywhere two or three pipol gada for my name, I go dey der with dem.”
How To Take Forgive
21 Den Pita kon ask Jesus, “Oga God, how many times I go forgive my broda wey do mi bad? Na seven times?”
22 Jesus ansa am, “Nor bi only seven times I tell yu, but na four hundred and ninty times!”
Di Savant Wey Nor Agri Forgive
23 “God Kingdom bi like wen one king wey won know how en savants dey manage en business. 24 As di king dey shek di akkount, dem kon bring one savant wey dey whole 10,000 koins kom. 25 Bikos e nor fit pay wetin e whole, di king kon orda make dem sell di man, en wife, en shidren and evritin wey e get, take pay di debt.
26 “So, di savant fall for di king front dey beg, ‘Oga God, make yu dey patient with mi, I go pay yu evritin.’ 27 Di king sorry for di savant kon release am sey make e nor pay again.
28 “Afta, di same savant kon si anoda savant wey dey hold am hundred silva koins. E seize am for troat nearly kill-am kon tell am, ‘Make yu pay mi my money.’
29 “Di savant wey e seize for troat kon fall for groun dey beg am, ‘Make yu dey patient with mi, I go pay yu yor money.’
30 “But e nor gri. Instead e karry am go put for prison, until e go pay wetin e whole. 31 Wen di oda savants si wetin happen, dem nor happy at-all, so dem kon go tell di king evritin wey happen.
32 “So di king koll di first savant kon tell am, ‘Yu wiked savant! I forgive yu di big debt wey yu whole mi, bikos yu beg! 33 Wetin make yu nor sorry for anoda savant like yu, just as I sorry for yu?’ 34 With vexnashon, di king kon give di savant to soja make dem sofa am well-well, until e pay evritin wey e dey whole.
35 “So, na like dis too my Papa for heaven go do una, if una nor forgive una brodas from una heart.”