23
Seven Trobol
Jesus kon tell di pipol and en disciples sey, “Na di law tishas and Farisee pipol dey tok wetin Moses Law mean. So make una listin and do wetin dem dey tell una. But nor do wetin dem dey do, bikos dem nor dey do wetin dem dey tish. Dem dey put heavy load for pipol shoulder and dem nor ready to help dem.
“All wetin dem dey do, na make pipol for si dem. Dem dey tie tins wey dem rite God word put for dia fore head and hand, so dat pipol go si dem. Dem like betta place for party and betta chair for inside sinagog. Dem like make pipol dey greet dem with respet for market and make pipol dey koll dem, ‘Tisha.’
“Nor let anybody koll yu ‘Tisha,’ bikos na only one tisha una get and all of una na brodas. Make una nor koll anybody for dis world ‘Papa’, bikos na only one real Papa una get and e dey for heaven. 10 Make yu nor let pipol koll yu ‘Leader’, bikos na only one leader una get and na-im bi Christ. 11 Di pesin wey big pass among una, go bi una savant. 12 Anybody wey dey karry body up, God go bring am down and anybody wey nor dey karry body up, God go raiz am up.
13 “But e go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una klose door make pipol nor for fit enter God Kingdom! Unasef nor won enter and una nor won make odas enter. 14 E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una dey use long prayer shit wimen wey dia husband don die, bikos of dis, God go ponish una well-well.”
15 “E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una dey travel go evriwhere just to win one pesin kon meet God and afta una don win am, una go kon make am bad well-well like devil pikin, pass as una bi!
16 “E go bad for una, leaders wey blind, una sey, ‘Anybody wey take di temple swear, nor-tin go do am. But if e take di gold for Temple swear, curse go dey for en head.’ 17 Una bi fool wey blind! Wish one big pass, na di gold or di temple wey make di gold holy? 18 Una dey tish sey, ‘Anybody wey take di altar swear, nor-tin go do am, but if pesin take wetin dey for di altar swear, e must do wetin e tok.’ 19 Una blind o-o! Wish one big pass, na di gift or di altar wey make di gift holy? 20 So, anybody wey take di altar swear, na both di altar and evritin wey dey inside, e take swear. 21 And anybody wey take di temple swear, na both di temple and God wey dey stay inside, e take swear. 22 Anybody wey take heaven swear, na both God throne and di Pesin wey sidan put, e take swear.
23 “E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una dey give one out of evry ten tins wey una get, but una nor dey do di important tin wey di law tok, wey bi to give korrect judgement, to trit pipol well and to do wetin dey good! Una suppose to dey do dis tins join di oda one. 24 Una wey bi oga wey blind! Una dey remove fly from una drink, but una dey swallow melu!
25 “E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una dey wosh cup and plate body make dem for klean, but bad belle and long-trot full inside una. 26 Una Farisee pipol wey blind! Make una first wosh inside di cup, den di outside go klean too!
27 “E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una bi like grave wey fine for outside, but di pesin body for inside, don rotin. 28 Na so e bi with una too, for outside, una bi like good pipol, but for inside, na wayo and sin full una life.
29 “E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una build grave for di profet wey don die kon dekorate koffin for pipol wey fear God. 30 And una sey, ‘If to sey wi dey alive for awa grand-grand papa time, wi nor for help dem wen dem dey kill di profets.’ 31 So na una grand-grand papa dem kill di profets. 32 Make una go finish di work wey una grand-grand papa dem start!
33 “Una bi snake! Wiked snake shidren! How una go take eskape hell? 34 I go send profets, wise pipol and law tishas kom meet una and una go kill and nail some for cross, flog some inside una sinagog, den porshu di odas from one town go anoda. 35 So all God pipol blood wey una kill for dis world, go dey una head. From Abel blood go rish Zekaraya wey bi Barakaya pikin, wey una kill for inside di temple. 36 I tell una true word, pipol for dis generashon go sofa di ponishment for dis tins wey una do!”
God Go Judge Israel
37 “O! Jerusalem pipol, O! Jerusalem pipol! Una wey kill di profets and stone di pipol wey God send kom meet una! I don dey try to gada una shidren as fawol dey gada en shidren under am, but una nor let mi do am. 38 Si, from today go, una go skata and una house go empty. 39 Make una know sey, una nor go si mi again until una go sey, ‘Make God bless di pesin wey kom with God name!’ ”