12
Pesin wey dey happy wen dem korrect am, get wisdom,
but anybody wey dey vex wen dem korrect am, nor get sense.
God dey happy with good pipol,
but E dey kondemn doz wey dey plan wiked tins.
Wikedness nor dey pay pesin,
but nor-tin dey shake good pipol.
Good wife dey bring joy and pride to en husband;
but wife wey dey bring shame for en husband
bi like diziz for en bone.
Good pipol dey always tink good,
but make yu nor ever trust anytin wey wiked pipol tell yu.
Wiked pipol word dey kill,
but raitious pipol word dey save pipol.
Wiked pipol dey die trowey,
but doz wey dey fear God, dey get long life.
Dem dey praiz pesin wey get sense,
but nobody dey respet wiked pesin.
E betta make yu bi ordinary pesin wey dey work to chop,
dan to dey karry body up wen yu nor even get garri to soak.
10 Raitious pipol dey kare for dia animals,
but wiked pipol dey trit dia own anyhow.
11 Pesin wey dey work hard, always get plenty to chop,
but pesin wey dey porshu dis world tins, nor get sense.
12 Pipol wey bi tif dey jealous wetin odas tif,
but wetin raitious pipol get, dey rish dem,
bikos dem dey work for dia own food.
13 Wiked pipol words dey put dem for wahala,
but raitious pipol go eskape from trobol.
14 Wise word get gain
and hard work dey bring reward.
15 Foolish pipol dey always tink sey wetin dem dey do dey korrect,
but wise pipol dey listin to odas.
16 Foolish pipol dey kwik vex,
but wise men nor dey tok even wen dem curse dem.
17 Good witness dey tok trut,
but wiked pipol dey always lie.
18 Foolish pipol dey tok anyhow,
but wetin wise pipol tok, dey heal many wound.
19 Trut go last forever,
but lie-lie nor dey tey before evribody go know sey na lie.
20 Pesin wey dey tink so-so bad-bad tins, na wikedness full en heart,
but doz wey like peace, get joy for dia life.
21 Wahala nor fit kom meet doz wey dey fear God,
but na trobol dey always follow wiked pipol.
22 God hate pipol wey dey lie,
but E like doz wey dey tok trut.
23 Wise pipol nor dey karry body up,
but foolish pipol dey show dia foolishness.
24 Na only doz wey work hard go fit lead odas,
but lazy pipol go bi slave.
25 If pesin dey worry, e go make am sick,
but betta word go make yor body strong again.
26 Doz wey dey fear God dey advise dia friends well,
but wiked pipol dey lead dem enter wahala.
27 Lazy pipol nor even fit kook di animal wey dem katch,
but doz wey get sense, dey use evritin wey dem get, well.
28 Doz wey dey follow God, go get life
and dis way wey dem dey follow, nor dey kause deat.