100
Praiz Song
Make evritin wey dey dis eart,
shaut with joy to God!
Make una happy as una dey woship God.
Make una sing with joy as una dey kom meet am.
Make una know sey na di Oga God bi God!
Na-im make us and wi bi en pipol.
Wi bi en pipol, di sheep wey dey en field.
So make una sing tanksgivin song as una dey enter en present!
Make una enter en temple with tanksgivin.
Make una tank and praiz en name.
Bikos God dey good, en love wey nor dey fail dey forever
and E dey good from one generashon go rish anoda.