103
God Love Us
David song
My soul, make Yu praiz God!
Make evritin wey dey inside mi, praiz en holy name!
My soul, make Yu praiz God!
Make Yu nor forget all di good tins wey E don do!
Na-im dey forgive pipol dia sins
and dey heal difren-difren diziz.
E save awa life from di pit
kon crown us with mesi and en love wey nor dey fail.
E satisfy awa life with good tins and even as wi still dey yong,
awa life strong like eagle own.
God dey do wetin dey good
and dey judge well for doz wey dem dey opress.
God show en good works to Moses
and en faithfulnes to Israel pipol.
God dey sorry and show mesi to pipol well-well;
E nor dey kwik vex and en love for us nor dey fail.
E nor dey always akuiz pipol
or vex tey for dem.
10 E nor dey use as awa sin big rish,
take ponish us.
11 As di sky high from di eart,
na so too en love for pipol wey dey fear and serve am, big rish.
12 Just as east far from west,
na so too E make awa sins far from us.
13 Just as papa dey love and pity for en shidren, na so too,
God dey good and dey sorry for doz wey dey fear am.
14 Bikos E know how E take kreate us
kon remember sey na dust wi bi.
15 Awa days for dis world bi like grass;
just as flower dey shine kon die, na so too wi dey shine,
but small time wi go die.
16 Wons heavy breeze blow,
di flower dey die komot like sey e nor dey der before.
17 But God love go dey forever for pipol wey dey fear am.
En salvashon go dey for dia shidren-shidren;
18 doz wey dey faithful to en kovenant
and dey obey en kommand!
19 God don make heaven en throne
and na from der E dey rule evritin.
20 So angels, make una praiz God:
Di strong angels wey dey obey am and listin to all en kommand.
21 Yes! Make una praiz God,
all di strong angels wey dey serve and do wetin E wont!
22 Evritin wey God kreate,
make una praiz God for evriwhere for en kingdom.
Make my soul praiz God!