105
God And En Pipol
Make wi tank Oga God!
Make wi koll en name kon tell di whole world
about di tins wey E don do.
Make wi sing to am.
Yes! Make wi sing to am.
Make wi tink about all di wonderful tins wey E do!
Make wi praiz en holy name and wi wey dey woship God,
make wi happy.
Make wi look for God and en pawa wey E dey give!
Make wi always dey look for am!
Make wi remember all di wonderful tins wey E do;
en mirakles and laws wey E give
us wey bi en savants, Abraham shidren
and wi wey bi Jakob wey E choose, shidren-shidren.
Na-im bi di Oga awa God.
Pipol dey si di way E dey judge for di whole land.
E always dey keep en kovenant;
di promise wey E make give 1,000 generashon.
Dis na di kovenant wey E make with Abraham
and E swear about am give Isaak.
10 E give di promise to Jakob, just as E kommand and for Israel pipol,
na kovenant wey nor dey end, bikos E sey:
11 “I go give una Kanaan land
and e go bi una special propaty.”
12 E tok dis tin wen dem neva plenty and dat time,
dem just bi strenjas for Kanaan land.
13 Dem waka from kountry to kountry,
from one kingdom to anoda.
14 Yet, E nor let anybody opress dem.
E warn kings bikos of dem sey:
15 “Make una nor tosh dis pipol wey I choose
and make una nor plan to do bad tins against my profets.”
16 E kause honga for Kanaan land wen E
nor make di groun bear betta food for dem.
17 Den E send Josef go Egypt for en pipol front
wen en brodas sell am as slave.
18 Di shain for Josef leg kon dey pain am
and dem put iron for en neck.
19 Until di time rish for Josef to do wetin e dream
and tok about, God still dey test en karata.
20 Den Fero send for am kon free am.
Na di rulers for di nashon open di prison door
21 and Fero make Josef oga for evritin wey dey en house;
so Josef kon bi oga for evritin wey di king get.
22 E fit send doz wey dey serve di king as e wont
kon tish doz wey dey advise di king.
23 Den Israel kon go Egypt
and Jakob stay as strenja for Ham land.
24 So God kon make Israel pipol plenty
and dem kon too many for dia enemies to handle.
25 Den God turn Egypt pipol against Israel pipol and dem kon plan against God pipol.
26 But God send en savant Moses with Aaron wey E choose,
go free en pipol.
27 Dem do wonderful tins for Egypt pipol front
and for Ham land.
28 God kover Egypt with darkness,
bikos dem nor gri allow en pipol go.
29 E turn dia wota to blood
kon poizin all dia fish.
30 Den frog kon full di town
and dem even enter di king bedroom.
31 Wen God tok,
fly kon enter Egypt and worm kon full evriwhere.
32 God allow strong block fall for Egypt instead of ordinary rain
and tonda dey make nois for di whole land.
33 E distroy dia grape vine
and fig tree kon skata all dia trees.
34 God tok and many-many lokust kon kom;
small-small lokust wey dem nor fit kount.
35 Dem chop evry green leaf for di land
kon kill all di plants for Egypt.
36 Den God kill both di pipol and dia animals first-born for Egypt
and na dem bi di pride and joy of dia family.
37 God take en pipol komot from Egypt with many silva and gold
and e nor get any tribe for Israel wey faint for road.
38 Egypt pipol happy wen Israel pipol dey komot from dia land,
bikos dem dey fear Israel pipol well-well.
39 God kover Israel pipol with kloud
kon give dem big fire as lite for nite.
40 Dem ask for meat and God give dem kwail bird;
E give dem manna wey bi bread from heaven,
so dat dem go chop beleful.
41 E divide di rock and wota kom out
kon form river for di dry land,
42 bikos E remember en promise
wey E make with en savant, Abraham.
43 So E take en pipol komot Egypt with joy;
di pipol wey E choose with happiness.
44 Doz wey nor know am, E give dia land to Israel en pipol
and dem plok fruit wey odas plant.
45 All dis tins happen make dem for dey follow God laws
kon obey en kommand.
So make wi praiz di Oga wey bi awa God!