112
Good Pesin Go Happy
Make wi praiz God!
Pesin wey dey obey and love to do wetin God kommand,
blessing dey follow am.
En shidren-shidren go get pawa for dis world
and God go bless di pipol wey dey obey am.
Dia house get plenty good propaty with money
and dia respet na forever.
Even for darkness,
lite dey shine for pipol wey dey fear God.
Dem dey good, dey sorry for pipol and dem get respet.
Pipol wey dey dash oda pipol money,
dey do dia business well and na dem good tins dey follow.
Evil nor go fit kill doz kind pipol.
Pipol wey dey raitious and good, pipol dey always remember dem.
Dem nor dey fear bad news;
dem always dey trust God sey E go kare and guide dem.
Dem get mind and dem nor dey fear
as dem dey fight and distroy dia enemies.
Dem dey share and give wetin dem get to poor pipol for free.
Pipol go always remember dia good work forever.
Dis kind pipol, go get respet and honor.
10 Wen wiked pipol si dis tins,
dem go dey fear and worry;
dem go grind dia tit dey vex;
dem go melt trowey
and evritin wey dem wont,
go distroy.