119
God Law
א (Alef)
Make una si as God dey bless pipol
wey dey do wetin dey rite and obey en kommand.
Pipol wey dey follow en rules
kon find am with all dia heart,
make una si as dia blessing many rish.
Dem nor dey do bad tins
and dem always dey obey God word.
God sey make wi obey
and keep yor kommand well-well.
If to sey I fit live my life
just as Yu tok
den I nor go shame,
bikos I dey follow wetin Yu tok.
As I dey learn evritin about yor raitiousness,
I go tank Yu as I dey live my life as I suppose to live am!
I go obey yor laws,
so my Oga God,
make Yu nor taya for mi!
To Obey God Law
ב (Bet)
Di only way yong pesin go if live betta life,
na to obey God word.
10 I don try well-well to find Yu.
Abeg, make Yu nor let mi go against yor kommand.
11 I don keep yor word for my heart,
so dat I nor go sin against Yu.
12 My God, I go praiz Yu,
so make Yu tish mi yor laws.
13 I dey shaut and tok about
all di kommands wey Yu give us.
14 Just as I dey happy to get propaty,
na so too I dey happy to obey di laws wey Yu give us.
15 I go learn yor kommand
kon study yor laws.
16 I go obey yor laws
and I nor go forget yor word.
Happiness Dey For God Law
ג (Gimel)
17 Make Yu dey good to mi wey bi yor savant,
so dat I go live and obey yor word.
18 Make Yu open my eyes to si di wonderful tins
wey dey yor law.
19 Na strenja I bi for dis world,
so make Yu nor hide yor kommand from mi!
20 I always dey happy
to dey learn yor rules and laws.
21 Yu porshu sturbon pipol;
doz wey nor dey obey yor kommand and bikos of dis,
curse dey dia head.
22 So make Yu nor let dem laf and curse mi,
bikos I dey obey yor kommand.
23 Even doh important pipol sidan dey plan against mi,
I go still dey tink of yor kommand,
24 bikos yor law dey sweet
and dem dey give mi good advise.
To Really Obey God Law
ד (Dalet)
25 I liedan dey roll for dust;
so make Yu save mi with yor word.
26 I tell Yu about my problems and Yu ansa mi.
Naw, make Yu tish mi yor laws.
27 Make Yu help mi undastand wetin yor kommandment mean
and I go always dey tink about di wonderful tins wey Yu dey do.
28 Make Yu enkourage mi with yor word,
so dat my pains nor go kill mi.
29 Make Yu nor let mi dey deceive mysef;
but make Yu allow mi know yor ways.
30 I don choose to follow Yu;
I don gri to live my life as yor word tok.
31 I hold yor laws well, so my God,
make Yu nor let shame katch mi!
32 I go run follow yor kommands,
bikos Yu dey make mi undastand life well-well.
Prayer To Undastand
ה (He)
33 My God, make Yu tish mi yor laws
and I go obey dem till I die.
34 Make Yu make mi undastand and I go obey evritin wey Yu tok
kon learn dem with all my heart.
35 Make Yu let mi follow yor kommand,
bikos na der my happiness dey.
36 Instead of to dey love money,
make Yu let mi dey worry to know yor laws!
37 Make Yu help mi take my eyes
komot from tins wey nor mean anytin
and give mi life thru yor word.
38 Make Yu tell mi again about yor promise
wey Yu make to di pipol wey dey fear and obey Yu.
39 Di tins wey dey make mi fear,
make Yu take dem komot from my life, bikos yor law dey good.
40 I dey wait since to obey yor kommand,
so make Yu make my life new again,
bikos Yu good well-well.
To Trust God Law
ו (Vav)
41 My God, make Yu give mi yor love wey nor dey fail
and di salvashon wey Yu promise mi.
42 Den I go fit ansa pipol wey dey won kill mi,
bikos I trust yor word.
43 Make Yu nor take yor word komot from my mout,
bikos na yor law dey give mi hope!
44 Den I go always dey obey yor laws
forever and ever.
45 I go dey save,
bikos na only yor kommand I dey follow.
46 I go speak to kings about yor laws
and I nor go shame.
47 Naw, make Yu si as I dey happy to obey yor kommand!
Si as I love dem well-well!
48 I honor and love yor kommand and I dey always tink of yor laws.
Konfident For God Law
ז (Zayin)
49 Make Yu remember di promise wey Yu make give mi,
bikos na-im bi my only hope.
50 Yor promise dey revive
and help mi wen I dey for trobol.
51 Na so-so laf wiked pipol dey laf mi,
yet, I dey still obey yor laws.
52 My Oga God, I dey tink about yor laws wey dey since
and dem dey konfort my soul.
53 I dey vex for wiked pipol,
bikos dem rijet wetin Yu tok.
54 Anywhere wey I dey,
na yor law bi di song wey I dey sing.
55 My God, for nite,
I dey remember yor name and I dey obey yor kommand.
56 Na to obey yor kommand bi evritin
wey I dey do for dis life.
Respet For God Law
ח (Khet)
57 Na Oga God dey guide and save mi!
So I promise to always dey obey yor word!
58 I wont yor blessing with all my heart,
so make Yu show mi mesi, just as Yu promise.
59 Wen I tink as my life bi naw, I kon choose to follow yor ways.
60 So, I go kwik-kwik dey do wetin Yu kommand.
61 Wiked pipol dey won drag mi enter sin,
but yor word dey strong for my heart.
62 I dey wake-up for nite dey tank Yu,
bikos of yor good laws.
63 Na pipol wey dey fear Yu bi my friends;
doz wey dey obey yor kommand.
64 My God, yor love wey nor dey fail, full di world;
so make Yu tish us yor laws!
To Value God Law
ט (Tet)
65 My God, Yu don do many good tins
for mi just as Yu promise!
66 I bilive yor kommand and naw,
make Yu tish mi how to judge well and to undastand yor laws!
67 I bin dey sofa, bikos I waka live yor ways,
but naw, I dey obey yor word.
68 Yu dey good and na only good tins Yu dey do;
so make Yu tish mi yor kommand!
69 Wiked pipol lie full my ear,
but I dey obey yor kommands with all my heart.
70 Dia heart dey empty and stupid,
but I dey happy for yor kommand.
71 My pains dey good for mi,
bikos e dey tish mi how to listin to yor kommand.
72 Yor kommand dey good to mi
pass plenty silva and gold.
Justice For God Law
י (Yod)
73 Na Yu make and kreate mi.
Naw, make Yu give mi di sense to follow yor kommand.
74 Make pipol wey dey fear Yu, dey happy wen dem si wetin Yu do for mi,
bikos I don put my hope for yor word.
75 My God, I know sey yor laws nor dey bad or hard.
Yu dey ponish mi, bikos e dey good for mi.
76 Naw, make yor love wey nor dey fail, konfort mi,
just as Yu promise mi wey bi yor savant.
77 Make Yu sorry for mi kon protet mi, so dat I nor go die,
bikos na yor law dey make belle sweet mi.
78 Make Yu disgrace doz wiked pipol wey dey lie for my head;
but I go always dey follow yor kommand.
79 Make Yu add mi join di pipol wey dey fear Yu;
doz wey know yor laws.
80 As I dey keep yor kommand, make evritin wey I dey do,
good for yor eye, so dat shame nor go katch mi.
Prayer To Diliver
כ (Kaf)
81 I taya as I dey wait make Yu save mi,
but I don put my hope for yor word.
82 My eye just dey look to si sey wetin Yu promise, dey happen.
So wen Yu go kom help mi?
83 I bi like leda bag wey skwiz, bikos e dey where smoke full,
yet I neva forget to obey yor kommandment.
84 So, na how long I go dey wait?
Na wen Yu go ponish di pipol wey dey wahala mi?
85 Doz wiked pipol wey hate yor laws
don dig pit to katch mi.
86 But all yor kommand dey good,
so make Yu protet mi from di pipol wey just like to kill mi.
87 Even doh dem don nearly kill mi,
I still dey obey yor kommands.
88 So make Yu save my life with yor love wey nor dey fail;
den I go kontinue to obey yor laws.
Faith For God Law
ל (Lamed)
89 My God, yor word wey dey forever,
stand gidigba for heaven.
90 Yu dey good to all generashon and na as Yu kreate di eart,
e still dey kon rish naw.
91 Evritin dey as dem dey kon rish today,
bikos evritin dey work as Yu plan am.
92 If to sey yor laws nor keep mi with joy,
I for don die with my pains.
93 I nor go ever forget yor kommand,
bikos na dem Yu take dey give mi life.
94 I bi yor own, so make Yu save mi,
bikos I don work well-well to obey yor kommand.
95 Even doh wiked pipol dey hide for road to kill mi,
I kwayet as I keep yor laws for my mind.
96 Naw, I don know sey evritin get where dem fit do rish and evribody get where dem know rish,
but nobody fit undastand yor kommandment finish.
Love For God Law
מ (Mem)
97 My God, si as I love yor laws
and I dey tink about dem evriday.
98 Yor kommandment make mi get sense pass my enemies,
bikos na dem dey always guide mi.
99 Yes, I get betta undastandin pass my tishas,
bikos I always dey tink of yor laws.
100 I even get sense pass my eldas,
bikos I dey keep yor kommandment.
101 I don decide sey I nor go do any bad tin,
so dat I go always dey obey yor word.
102 I neva sin against yor laws,
bikos Yu tish mi well.
103 Yor word sweet well-well for my mout;
dem even sweet pass honey.
104 Yor kommandment don make mi undastand life well
and na-im make mi hate to do bad tins.
Lite For God Law
נ (Nun)
105 Yor word na lantan wey dey guide my leg and lite wey dey make mi si road.
106 I don first promise and I dey promise again sey; I go always dey obey all yor kommandment.
107 My God, I don sofa well-well; so make Yu save my life just as Yu promise.
108 My God make Yu asept di ofrin wey my praiz bring and tish mi yor kommandment.
109 Even doh my life nor balance at-all, I nor go stop to obey yor kommandment.
110 Even doh wiked pipol set dia trap for mi, I nor go turn from yor kommandment.
111 Na yor laws bi my special propaty; na dem my heart wont
112 and I dey ready to keep wetin Yu tok till I die.
Save Place For God Law
ס (Samek)
113 I hate pipol wey dey pritend sey dem dey loyal to evribody,
but I love yor kommandment.
114 Na Yu bi my proteshon and guide
and na yor word dey give mi hope.
115 Una wey bi sey na wiked and evil tins full una mind, make una komot from my life;
bikos na my God kommandment I go obey till I die.
116 My God, make Yu give mi life as Yu promise,
so dat I nor go die!
117 Make Yu keep mi and I go dey save;
den I go always dey follow wetin Yu tok.
118 Yu don rijet all di pipol wey nor dey follow yor ways and naw,
dem just dey fool diasef.
119 Yu swip wiked pipol komot dis world like dirty;
know wonder I dey love to obey yor laws!
120 I dey shake bikos I dey fear Yu
and yor kommandments and rules dey make mi sopraiz.
To Obey God Law
ע (Ayin)
121 I dey do wetin dey rite,
so make Yu nor leave mi for doz wey dey opress mi.
122 Abeg, make sure sey Yu bless mi
and nor let sturbon pipol opress mi!
123 I don taya to look, to si weda Yu go kom save mi;
so dat evritin go bi just as Yu promise mi.
124 I bi yor savant, so make Yu show mi yor love wey nor dey fail
kon tish mi yor laws.
125 I bi yor savant, so make Yu give mi sense,
so dat I go undastand yor rules.
126 E don rish time wey God go take akshon,
bikos dis wiked pipol dey break en laws.
127 True-true, I love yor kommand pass gold
and I even love am pass di gold wey fine pass.
128 All yor kommands dey korrect
and dat na di rizin why I hate to do bad tins.
To Love And Obey God Law
פ (Pe)
129 Yor laws dey wonderful.
No wonder I dey obey dem!
130 Di tishing for yor word dey give lite,
so even pipol wey nor go skool dey undastand am.
131 I dey hongry for yor kommandment;
I dey wait for yor laws.
132 Make Yu kom show mi yor mesi,
just as Yu dey do to evribody wey love yor name.
133 Make yor words guide my step,
so dat I nor go waka enter evil.
134 Make Yu save mi from wiked pipol wey dey opress mi;
den I fit obey yor kommandment well.
135 Make Yu look mi with love kon tish mi yor laws.
136 I dey kry like river wey dey flow,
bikos pipol nor gri obey yor kommands.
God Law And Justice
צ (Tsade)
137 My God, na Yu bi my raitiousness
and yor laws good well-well.
138 Yor rules dey pafet
and wi go fit trust dem.
139 E dey pain mi well-well wen my enemies
nor gri listin to yor laws.
140 I don test yor promise well-well
kon si sey dem dey pure and dat na why I always dey love dem.
141 Even doh I nor mean anytin at-all to pipol,
I nor go fit forget yor kommand.
142 Yor judgement na forever
and yor laws dey pafet and true.
143 Even doh pressure and wahala dey make mi taya,
yor kommand still dey make mi happy.
144 Yor laws always dey rite;
so make Yu help mi undastand dem, so dat I nor go die.
Prayer To Diliver
ק (Qof)
145 My God, make Yu ansa mi,
bikos I dey pray with all my heart,
so dat I go always dey obey yor laws.
146 Make Yu save mi,
bikos I dey kry to Yu make I for fit obey yor kommand.
147 I dey wake-up before day break well
and yor words dey give mi hope.
148 I nor dey sleep for nite,
bikos I dey tink about yor promise.
149 So my God, make Yu hear my kry, bikos of yor love wey nor dey fail!
Make Yu save mi as Yu dey always do.
150 Pipol wey nor dey obey yor law dey kom attack mi;
dem nor dey listin to yor kommand at-all at-all.
151 But my Oga God, Yu dey near and all yor kommand na true
152 and I don know from small pikin sey,
yor laws go dey forever and ever.
Beg For Help
ר (Resh)
153 Make Yu si di sofa wey I dey sofa kom save mi,
bikos I neva forget yor laws.
154 Make Yu kom fight
and protet my life just as Yu promise.
155 Nobody go save wiked pipol,
bikos yor laws nor koncern dem at-all.
156 My God, si as yor mesi great rish;
so make yor laws dey give mi hope as I dey do dem.
157 Many pipol dey trobol and wahala mi,
yet I neva run or turn from yor laws.
158 Wen I si lie-lie pipol, e dey make mi sick,
bikos dem nor kare about yor kommandment.
159 My God, make Yu si how I love yor kommands.
Make Yu give mi back my life, bikos of yor love wey nor dey fail.
160 All yor kommand na true
and all yor laws go last forever.
Bilive God Law
שׂ / שׁ (Sin/Shin)
161 Pipol wey get pawa dey trobol mi wen I nor do dem anytin,
but na only yor word dey make my heart shake.
162 Like pesin wey si many propaty karry for war,
na so too I dey happy to hear yor word.
163 Pipol wey dey lie and go against yor word,
I hate dem well-well, bikos I love evritin wey Yu tok.
164 I go praiz Yu seven times for one day,
bikos all yor laws dey rite.
165 Pipol wey love wetin Yu tok,
get peace of mind and dem nor dey fear, shake or fall.
166 My God, I dey wait since make Yu
kom save mi and I dey obey yor kommand.
167 I dey obey yor laws,
bikos I love dem well-well.
168 Yes, I dey obey yor kommandment and yor laws,
bikos Yu know evritin wey I dey do.
Prayer For Help
ת (Tav)
169 My God, make Yu listin to my kry;
make Yu give mi betta sense thru yor word!
170 Make Yu listin to my prayers
kon save mi just as Yu promise.
171 Make praiz dey always kom out from my mout,
bikos Yu don tish mi yor laws.
172 Make my tongue sing about yor word,
bikos all yor kommandment dey rite.
173 Make Yu help mi,
bikos I don choose to obey and follow yor kommandment.
174 My God, e don tey wen I dey wait make Yu kom save mi,
bikos na yor laws dey give mi hope.
175 Make I dey dis life,
make yor laws kon help mi, so dat I go always dey praiz Yu.
176 I dey waka go like sheep wey waka lost for bush,
so make Yu kom find mi,
bikos I neva forget yor laws.