22
Praiz God Inside Pain
For Di Kwayamasta: David Song
My God, my God, wetin make Yu forget mi?
Wetin make Yu dey far from mi wen I dey kry for help?
My God, na evriday I dey koll Yu, but Yu nor dey ansa.
Na evry nite Yu dey hear my vois, yet I still dey sofa.
Yu dey holy
and na Yu get all di praiz for Israel.
Awa grand-grand papa dem trust Yu
and Yu save dem.
Dem kry give Yu and Yu diliver dem.
Dem trust Yu and Yu nor ever disgrace dem.
But naw, I don turn worm instead of man.
Evribody hate and dey laf mi!
Anybody wey si mi, dey laf mi.
Dem go look mi kon shake dia head sey,
“Nor bi dis man trust God?
Make God save am naw!
If God love am well-well, make E kon diliver am naw!”
Yet Yu allow my mama born mi well
and I trust Yu from small pikin.
10 Dem born mi put for yor hand and na Yu dey kare for mi.
Na Yu bi my God from di time wen dem born mi kom rish naw.
11 So, make Yu nor too stay far from mi,
bikos trobol dey near and no oda pesin fit help mi.
12 My enemies gada round mi like strong melu and wiked animals from Bashan.
Dem gada won bite mi!
13 Dem dey open dia mout against mi
like lion wey dey hongry.
14 My life bi like wota wey dem trowey and all my bones don skata.
My heart bi like kandol wey dey melt inside mi.
15 My strent don dry like mold wey sun beat.
My tongue don gum my mout.
Yu don trow mi for groun kon leave mi make I die for der.
16 My enemies gada round mi like many dogs and bad-bad pipol dey kom katch mi.
Dem don shuk my hand and leg.
17 Naw, I fit kount all my bones
and my enemies dey laf as dem dey look mi.
18 Dem divide my klot among demsef.
Dem trow dice take divide my garment.
19 My God, nor dey far from mi!
Na Yu bi my strent; make Yu kwik kom save mi!
20 Make Yu save mi from di swod
kon guide my life from doz dogs.
21 Take mi komot from di lion mout
and from di wiked melu horn.
22 I go tok about yor name for where my kountry pipol dey.
I go praiz Yu for where yor pipol gada put.
23 Evribody wey dey fear God, kom make wi praiz am!
All Jakob shidren-shidren, make una kom make wi honor am!
24 Bikos E nor leave or forget poor pipol as dem dey sofa.
E neva turn en back to dem, but E dey listin to dia kry for help.
25 I go praiz Yu for where yor pipol gada.
Doz wey dey woship Yu, na for dia present I go for do wetin I vow.
26 Make doz wey dem dey opress,
si food kon chop beleful.
Evribody wey dey fine God, go praiz am
and dia heart go dey happy with joy wey nor dey end.
27 Di whole eart go know God kon run go meet am.
Evribody for di world go bow woship am.
28 Bikos na God bi di king wey get pawa
and E dey rules evry nashon.
29 Make rish pipol for di world kom woship am.
Evribody must bow to am, plus doz wey don die
and doz wey nor fit save dia own life.
30 Awa shidren sef go serve Yu.
Awa shidren-shidren go hear about di wonders wey God don do.
31 Dem go tell doz wey dem neva born naw about all di good tins wey God dey do.
Dem go hear about evritin wey E don do.