24
Di Great King
David Song
Na God get di eart and evritin wey dey inside.
Di world and evribody wey dey stay inside, na en own too.
E build di eart foundashon on-top sea
kon make am stand on-top wota.
Na who go fit klimb go God mountin?
Na who go fit stand for en Holy Place?
Na only doz wey get klean hand and pure heart;
pipol wey nor dey serve juju or lie or do bad tins.
Dem go get God blessing
kon bi di God wey dey save dem, friend.
Dis kind pipol dey go find and woship am,
bikos na-im bi di Oga wey bi Jakob God.
Naw, evry old gate, make una open!
Evry old door, make una open,
so dat di King wey get glory go enter inside.
Who bi dis King wey get glory?
Na God wey dey strong and get pawa well-well;
God wey get pawa to fight war.
Naw, evry old gate, make una open!
Evry old door, make una open,
so dat di King wey get glory go enter inside.
10 Who bi dis King wey get glory?
Na di Oga God of all ogas;
Na-im bi di King wey get glory.