27
Prayer To Praiz God
David Song
Na God bi my lite and my salvashon,
so na who I go kon dey fear?
Na en dey guide and protet mi from danger,
so wetin go make mi dey shake?
Wen wiked pipol and my enemies won kom attack and kill mi,
dem dey stagga fall.
Even doh strong sojas gada round mi, my heart nor go fear.
Even if dem attack mi, I don go shek at-all.
Na only one tin I ask from God
and dat na wetin I wont!
Na make I stay for God house forever,
so dat I go dey si en mighty works
kon always dey happy for inside en temple.
Bikos E go must guide mi wen trobol kom kon hide mi for en temple.
E go put mi on-top one high rock where nobody go fit tosh mi.
Den I go win my enemies wey gada round mi!
I go offa sakrifice for dis temple and shaut for joy!
I go dey sing and praiz my Oga God.
So my God, make Yu hear my prayer.
Make Yu show mi mesi!
My heart sey make I pray to Yu
and I kon pray to Yu my Oga and God.
Make Yu nor rijet mi.
Nor vex push yor savant komot from yor present,
bikos na Yu dey diliver mi.
So, make Yu nor leave or abandon mi,
bikos na Yu dey fight for mi.
10 Even if my papa and mama abandon mi,
God go hold mi klose.
11 My God, make Yu tish mi how I go live my life
and bikos my enemies hide for korna dey wait to distroy mi,
make Yu lead mi pass di rite road.
12 Nor let mi fall enter dia hand,
bikos dem dey akuiz mi for wetin I nor do
and dem always dey treaten mi.
13 But where I for dey naw, if to sey I nor bilive
sey God go favor mi for dis land wey wi dey?
14 So, make yu dey patient, as yu dey wait for God and get strong mind.
Yes! Make yu dey patient, as yu dey wait for am.