5
Prayer For Proteshon
For Di Kwayamasta: Di Song
My Oga God, make Yu listin as I dey pray to Yu!
Make Yu listin to my komplain.
My King and my God,
make Yu listin to my kry for help,
bikos na only Yu I dey pray to.
Make Yu listin to my vois for morning, bikos evry morning,
I dey kom meet Yu and dey wait with patient make Yu ansa mi.
My God, Yu nor dey like bad tins;
Yu nor fit bear wiked pipol sins.
So, proud pipol nor go fit stand for yor present,
bikos Yu hate anybody wey dey do bad tin.
Yu go distroy doz wey dey lie well-well.
God nor like doz wey dey kill and deceive pipol.
Bikos of yor love wey nor dey die,
I go enter yor house
kon bow woship Yu for yor holy temple.
My God, make Yu save mi as Yu dey lead mi,
bikos my enemies dey korna dey wait to katch mi.
Make Yu remove all di problem wey dey di road
wey Yu dey take mi pass,
bikos my enemies nor dey tok di trut.
Wetin dey hongry dem to do, na to distroy odas;
dia troat bi like open grave
and na so-so lie-lie words full dia mout.
10 My God, make Yu disgrace dem.
Make dia own trap katch dem.
Make Yu drive dem,
bikos of dia sins and bikos dem don turn against Yu.
11 But make doz wey Yu dey guide, always dey happy!
Make dem always dey shaut for joy!
Guide dem, so dat doz wey loyal to Yu, go happy!
12 My God, true-true, Yu dey reward doz wey dey fear Yu.
Yu dey always protet dem well-well,
bikos of yor favor wey nor dey end.