55
Pesin Wey En Friend Betray Am, Prayer
David Song For Di Kwayamasta
My God, listin to my prayer.
Nor trowey yor face wen I dey kry for help!
Abeg, make Yu listin kon ansa mi,
bikos di trobol wey dey face mi, too mush.
My enemies dey shaut for mi;
dem dey shaut and treaten mi well-well.
Dem dey karry wahala kom
and dem won kill mi.
My heart dey beat for my chest and bikos of deat,
I kon dey fear.
I just dey fear dey shake anyhow
and I nor fit stop to shake.
I wish sey I get feada like dove,
I for don fly go where I go rest!
I go fly go far; go rest for wildaness
bikos e dey kwayet.
I go kwik run go
where I go dey save from dis pipol
wey hate mi well-well.
So my God, make Yu konfuse and skata dia plans,
bikos na wahala and konfushon I dey si for di town.
10 Both for day and nite,
dem dey waka on-top di town wall
and na wikedness and distroshon full der.
11 Evritin don skata and na so-so to dey treaten
and shit pipol, full di town.
12 If to sey na enemy dey laf mi,
I for fit bear-am.
If to sey na enemies dey make mout for mi,
I for fit hide from dem.
13 But na yu my klose friend;
di pesin wey I like well-well.
14 Wi don tell each oda awa sekret;
wi dey waka togeda among di pipol wey dey God Temple.
15 Make deat distroy my enemies;
make di grave swallow dem alive,
bikos na wikedness dem dey stay with.
16 But I go koll my God
and E go kon save mi.
17 For morning, aftanoon and nite,
I dey kry with pain and God hear my vois.
18 E go diliver and save mi from pipol
wey dey plan against mi,
even doh dem many well-well.
19 God wey dey rule forever go hear mi kon deal with dem,
bikos my enemies nor gri shange from di wiked tins
wey dem dey do and dem nor dey fear God.
20 Dem dey attack dia friends
and break di promise wey dem make with dem.
21 Dia words dey smooth like butter,
but dia heart strong like stone.
Dia word smooth well-well like pomade,
but na dagger dey under dia tongue!
22 So make una give all una trobol to God,
bikos E kare about una.
E nor go allow pipol wey dey obey am,
draw fall for groun.
23 But Yu, my Oga God!
Yu go send wiked pipol go di pit where distroshon dey.
Doz wey dey kill pipol and doz wey dey lie, go kwik die,
but as for mi,
I go trust di Oga, wey bi my God.