66
Praiz And Tanksgivin Song
Dis Song Na For Di Kwayamasta
Make di whole eart shaut with joy
as dem dey praiz God!
Make una sing about di glory wey en name dey bring!
Make una tell di world how en glory big rish.
Make una tell God, “Si as di tins wey Yu do dey great.
Yu skata yor enemies with yor strong pawa!
Evritin for eart go woship Yu;
dem go sing yor praiz kon dey shaut for glory
as dem dey koll yor name.”
Make una kom si wetin God don do;
di wonderful mirakles wey E do among en pipol!
E turn di Red Sea to dry land
and en pipol kon dey happy
as dem dey waka pass di dry groun.
Na en great pawa E take dey rule forever.
E dey si evritin wey di nashons dey do;
so make wiked pipol nor dey karry body.
Make di whole world bless awa God!
Make dem shaut tell evribody about en praiz.
Awa life dey en hand
and E nor let us fall.
10 My God, Yu don test
and make us klean like silva.
11 Before-before, Yu katch us for yor net
kon make us sofa well-well.
12 Yu allow men rule us;
wi dey pass thru fire and wota, but naw,
Yu don bring us kom where dey save.
13 I go enter yor temple with sakrifice;
I go do di tins wey I promise Yu;
14 di vow wey I tok with my mout
and my lip wen I dey trobol.
15 I go give Yu fat animals
as burnt ofrin,
plus di smell from ram wey dem sakrifice.
I go give Yu melu and goats.
16 Kom! All of una wey dey loyal to God,
make una listin as I dey tok wetin E do for mi!
17 I kry to am make E help mi
kon praiz am with my tongue.
18 If I gada sin for my heart,
God nor go ansa or listin to mi.
19 But God dey hear
and listin to my prayers.
20 Na God get all di praiz, bikos E nor rijet my prayers
and E still dey show mi en love wey nor dey fail!