71
Old Man Prayer
My God, I don run kom meet Yu make Yu protet mi;
so nor let dem disgrace mi.
Make Yu kom take and save mi, bikos Yu dey do wetin dey rite.
Make Yu listin and diliver mi.
Make Yu bi my Savior and di Rock where I go always hide put.
Give kommand make dem save mi,
bikos Yu bi my rock and di place where I dey hide put.
My God, save mi from wiked pipol pawa
and from doz wey dey opress mi,
bikos na only Yu bi my hope and na from wen I bi small pikin,
I don dey trust Yu kom rish naw.
Yes! Yu don dey with mi since wen dem born mi
and Yu dey kare for mi from my mama belle.
No wonder I dey always praiz Yu!
My life na ezample to many pipol,
bikos na Yu bi my strent and proteshon.
Dat na why I nor fit stop to praiz Yu
and I go dey tok about yor glory evriday.
Naw, for my old age, make Yu nor rijet mi.
Make Yu nor leave mi wen I nor dey strong again.
10 My enemies dey gossip mi.
Dem dey plan how dem go take kill mi.
11 Dem dey sey, “God don rijet am.
So make wi go katch am, bikos nobody go help am again.”
12 So, my God, make Yu nor leave mi,
but make Yu hurry kom save mi.
13 Make Yu disgrace and distroy pipol wey dey akuiz mi.
Make disgrace and shame follow pipol wey won kill mi.
14 But for mi, I go always dey wait for yor help
and I go dey praiz Yu more and more.
15 I go tell evribody about yor raitiousness and evriday,
I go always dey tok about di pawa wey Yu take dey save,
even doh I nor really fit esplain how e bi.
16 My God wey get pawa,
I go praiz Yu bikos of all di great tins wey Yu don do.
I go tell evribody sey na only Yu dey do good.
17 My God, na from wen I bi small pikin,
Yu dey tish mi yor ways and I always dey tell pipol
about di wonderful tins wey Yu don do.
18 Naw wey I don old well-well, make Yu nor leave mi.
Make I tell dis new generashon
and all doz wey dey porshu mi about yor pawa.
19 My God, yor good judgement dey rish di heavens
and Yu don do many wonderful tins,
so na who bi like Yu?
20 Even doh Yu don make mi sofa well-well,
I know sey Yu go make mi happy again
kon take mi komot from di pit wey I dey.
21 I know sey Yu go karry mi put for where dem go for honor mi well,
so make Yu turn kon konfort mi.
22 Den I go praiz Yu with harp,
bikos Yu dey faithful to yor promise.
My God, I go use jita take sing
praiz Yu wey bi di Holy One for Israel.
23 I go shaut for joy kon sing with praiz,
bikos Yu don save mi
24 and till I die, I go always dey tell pipol about yor good works,
bikos evribody wey dey try to kill mi,
Yu don disgrace and make shame katch dem.