74
Prayer To Diliver
Asaf Song
My God, wetin make Yu rijet us forever?
Wetin make Yu dey vex for yor own sheep wey dey yor field?
Make Yu remember sey na wi bi di pipol wey Yu choose since Yu kreate di world;
di tribe wey Yu take as yor own!
Make Yu still remember Jerusalem where Yu dey stay.
Make Yu waka round di town wey dem skata;
den Yu go si as di enemies distroy yor temple.
Na for der yor enemies dey shaut and sing sey, “Dem don win.”
Na der dem for stand dia war flag.
Dem dey use dia axe
like doz wey dey kut wood for bush.
Dem use axe and knife take skata evritin
wey dem karve
kon burn yor temple rish groun.
Yes, dem distroy di place wey dey ansa yor name.
Den dem kon dey boast dey sey,
“Make wi distroy evritin!”
So dem burn evriwhere wey wi for dey woship God.
Naw, wi nor dey si yor mirakles again.
All di profets don die and nobody fit tell us
wen dis wahala go end.
10 So God, na how long e go take
before Yu go stop awa enemies wey dey curse us?
Yu go let dem take yor name make yeye forever?
11 Wetin make Yu nor won use yor strong rite hand against dem?
Make Yu kom distroy dem finish.
12 But Yu God don bi my King since my grand-grand papa dem time
and Yu dey save us for dis world.
13 Yu divide di sea with yor pawa
kon kill di monsta wey dey der.
14 Yu skata di wota juju head
kon allow animals for desert chop am.
15 Just as Yu get pawa to make wota and sea flow,
na so too, Yu fit dry river wey nor suppose dry.
16 Na Yu get both day and nite;
na Yu still make di moon and di sun.
17 Yu measure where di eart go rish
kon make both dry and rainin sizin.
18 My God, si as di enemies dey curse Yu.
Pipol wey nor get sense nor dey respet yor name.
19 Make Yu nor let dis wiked animal distroy yor pipol.
Yor pipol wey dey sofa, make Yu nor forget dem forever.
20 Make Yu remember yor kovenant,
bikos na darkness and trobol full di land!
21 Make Yu nor let dem disgrace pipol wey dey sofa.
Instead, make Yu let poor pipol and doz wey dem dey opress,
praiz yor name.
22 My God, make Yu raiz-up kon fight for mi.
Make Yu remember as dis fools dey curse Yu evriday.
23 Make Yu nor forget evritin wey yor enemies tok
or how dem dey shaut anyhow.