76
Asaf Song For Di Kwayamasta
God don show ensef to Judah pipol.
En name dey great among Israel pipol.
Na Jerusalem E dey stay
and na Mount Zion bi en house.
Na der E for break di enemies wiked arrow, dia guide,
swod and all di tins wey dem take dey fight.
En glory and majesty dey shine as E dey
kom from di mountin where E for kill en enemies.
Awa strong enemies don skata.
Dem don sleep kon die go like dat,
so nobody go fit fight us again.
My Oga wey bi Jakob God, wen Yu breath,
all yor enemies horse and shariot dey fall die.
No wonder dem dey fear Yu well-well!
Na who fit stand for yor front wen Yu dey vex?
Na from heaven Yu dey judge yor enemies;
di eart dey shake and dem dey kwayet for yor present.
My God, Yu dey judge di pipol wey dey do wiked tins
kon save doz wey dem dey opress for dis world.
10 True-true, di way Yu dey vex judge human being, go make dem praiz Yu.
Yu really dey show as Yu dey vex rish.
11 So, wen una vow give di Oga una God, make una keep una promise.
Make evribody bring gift kon give di Holy One!
12 E dey honbol prince and kings for dis eart,
dey fear am.