81
Feast Song
Asaf Song For Di Kwayamasta
Make wi sing praiz God wey bi awa strent.
Make wi sing praiz Jakob God.
Make una sing and play sheke-sheke.
Make una use jita and harp play sweet music.
Make una blow ram horn
wons new moon or full moon festival start!
Bikos dis na wetin dem rite for Israel law
and na wetin Jakob God kommand.
E make dis law for Israel pipol wen E attack Egypt land just to free us.
Den I hear one vois wey I nor know dey sey,
“Si, I don take di load komot from una shoulder;
I don free una from di heavy work wey una dey do.
Una kry to mi for help wen una dey trobol and I save una;
I ansa with strong tonda
kon test una faith wen wota nor dey to drink for Meribah.
My pipol make una listin to mi as I dey warn una!
Israel pipol, make una obey mi!
Una must nor serve anoda god;
una must nor bow before any oda god.
10 Bikos na mi wey bi una Oga God, save una from Egypt land.
Make una open una mout wide and I go pak good tins full am.
11 But my pipol nor gri listin.
Israel pipol nor wont make I dey with dem.
12 So I let dem do di tins wey dey hongry dem to do
kon live dia life di way dem wont am.
13 How I wish my pipol go gri listin to mi!
How I wish sey Israel pipol go follow mi kon do as I tell dem!
14 Den I for fit kwik distroy dia enemies!
My hand for kwik tosh doz wey dey worry dem!
15 Make pipol wey hate God, fear as dem si am;
make disgrace follow dem forever.
16 But I go give Israel pipol betta food chop;
I go make una beleful with betta honey
wey dey flow kom out from di rock.”