83
Prayer To Win Israel Enemies
Asaf Song
My God, make Yu nor kwayet just like dat!
Make Yu nor rijet us!
Nor just do like sey e nor koncern Yu!
Yu nor si di nois wey yor enemies dey make?
Yu nor dey si sey yor sturbon enemies dey make mout anyhow?
Dem dey plan against yor pipol
and dem won wound di ones wey Yu love.
Dem dey sey, “Make una kom make wi kill evribody for Israel finish
and nobody go remember dem again.”
All of dem gada togeda
and dem dey plan against Yu.
Dem wey gada so na:
Edom and Ishmael pipol,
Moab and Hagrit pipol;
Gebal, Ammon and Amalek pipol
with doz from Filistia and Tyre.
Assyria pipol don join dem
too with Lot shidren-shidren.
So, make Yu do dem wetin Yu do Midian pipol and just as Yu do Sisera and Jabin for Kishon River,
na so too Yu go do dem.
10 Dem die for Endor and dia body
kon make di grass grow well.
11 Make di mighty ones among dem die like Oreb and Zeeb.
Make all di prince die like Zebah and Zalmunna
12 wey bin sey,
“Make wi take dis land
wey bi God own!”
13 My God, make Yu skata dem like leaf
and san-san wey breeze dey blow!
14 As fire dey burn forest
and smoke dey make mountin burn,
15 na so too Yu go take porshu dem
with yor strong tonda
kon make dem fear.
16 My God, make Yu disgrace dem finish
until dem bigin praiz yor name.
17 Make shame and fear follow dem forever
and make dem die with disgrace.
18 Den dem go know sey na only Yu bi God,
di Pesin wey get pawa pass for di whole world.