3
God Dey Good
How Jew pipol take betta pass Gentile pipol sef? Or betta tin dey bikos dem sekonsaiz pesin? E really dey good to sekonsaiz pesin! And wi know sey na Jew pipol God first give en message. But wot if some for dem nor gri bilive? Dat mean sey God dey lie? Even doh evry human being dey lie, God nor fit lie. God word sey: “Make yu dey tok wetin bi trut; so dat yu go fit win yor kase wen dem dey judge yu.”
If God nor ponish us for di bad tins wey wi dey do, e mean sey God dey support us? No! So if God ponish us, wi go sey E dey wiked? (Na so some pipol dey tok). Wi nor fit tok so at-all! If God nor dey rite, na how E go kon take judge di world? If my lie-lie life dey show sey God word na trut, wetin go make am kondemn mi sey I bi sina? Den e go dey rite if wi sey, “Make wi dey do bad tins so dat good tins go kom out from wetin wi dey do?” But some pipol dey lie for my head, bikos of wetin I tok and God go ponish dem.
God Kondemn Di World
So wetin wi go tok? Wi go sey na wi wey bi Jew betta pass? Dat na lie! Bikos as I don already show una, Jew and Gentile pipol dey kommit sin. 10 Just as God word sey,
“Nobody dey raitious.
11 Nobody dey wey wise or undastand God.
12 Evribody don turn leave God,
all of dem don bi yeye for God eye.
Nobody dey do wetin good at-all.
13 Na lie wey fit kill pesin full dia mout
and wiked words full dia tongue.
14 Bad belle dey dia mind
and na so-so swear dem dey swear.
15 Dem go fit kwik kill pesin.
16 Anywhere dem go,
dem must fight skata di place
17 and dem nor know how to dey kwayet.
18 Dem nor dey fear God at-all.”
19 Wi know sey wetin di law tok, na for di pipol wey dey under di law. Di law tok like dis, so dat nobody go get eskuse wen God go judge di world. 20 Nobody dey good for God eye, bikos e dey obey di law. But na thru di law, wi take know wetin sin mean. 21 Naw, God don show us how wi go take dey good for en eye and nor bi thru di law, even doh na so Moses Law and di profets tok. 22 Na di faith wey pesin get for Jesus Christ go make am dey good for God eye. Anybody wey bilive Jesus, God dey make en faith strong, weda e bi Jew or Gentile pesin. 23 Evribody don sin and wi don fall komot from God glory, 24 but God don make us dey rite with am thru en free gift wey E give us, bikos of Jesus Christ wey save us. 25 Na God give us Jesus Christ, so dat thru en blood, E go forgive us awa sins wen wi bilive Christ. God do dis to show sey before-before, E dey patient to forgive pipol dia sins. 26 Dis still show sey God dey rite wen E asept pipol wey bilive Jesus Christ. E dey ponish sinnas, so dat wi go know sey en na God wey nor like sin. Like dis, God show sey en dey rite and anybody wey bilive Jesus Christ, E dey make dem dey rite too.
27 So, wetin make us dey boast? Wi nor fit boast at-all! Why e bi like dis? Na bikos wi dey obey di law? No! Na bikos wi bilive Jesus Christ. 28 So, na thru faith pesin go dey rite with God, nor bi as e obey di law rish. 29 Abi na only Jew pipol God dey dia side? E nor dey Gentile pipol side too? True-true, God dey Gentile pipol side. 30 Since na only one God dey, E dey for Jew and Gentile pipol, bikos of dia faith. 31 So make wi trowey di law bikos of faith? No way! E nor go work! Instead, wi go make di law strong well-well.