5
Kommand To Di Church
Make yu nor tok anyhow to pesin wey old pass yu, but dey tok to am with respet like sey yu dey tok to yor papa. Tok to yong men as yu go take tok to yor broda. Make yu trit wimen wey old pass yu like sey dem bi yor mama and wimen wey yu senior, make yu trit dem with good mind like sey dem bi yor sistas.
Respet and kare for wimen wey dia husband don die. But if di woman get shidren or grand-shidren, di first tin wey dem go do for dia family, na to show sey dem dey fear God, as dem dey kare for dia papa and mama. Dis na wetin dey make belle sweet God. Naw, woman wey en husband don die and e really dey alone for dis world, dey trust God. E dey pray for nite and day sey make God help am. But if e just dey enjoy ensef anyhow for dis world, dat mean sey en spirit don die, even doh e still dey alive. Make yu always dey give dis kommand so dat dem nor go get fault. But if anybody nor fit kare for en pipol, especially en family membas, e don deny di faith bi dat and e worse pass sina.
Woman wey don pass sixty years and e dey faithful to en husband bi for di man die, make una put am join doz wey di church dey help. 10 Evribody go know am for di good work wey e dey do sey: e don train shidren; dey welkom strenjas; dey serve God pipol; dey help doz wey nor get and e dey do difren good work.
11 But yong woman wey en husband just die, make una nor put am join doz wey di church dey help, bikos wen dem dey hongry to marry again, dem go fit leave Christ kon bigin sin. 12 So God go judge dem, bikos dem don break dia promise. 13 For di same time, dem go dey lazy, dey waka from house to house, dey do aproko and tok anyhow. 14 So I wont make di yong wimen marry; born shidren; dey guide dia house, so dat enemies nor go get shance to akuiz dem. 15 Bikos some pipol don already dey follow Satan.
16 If anybody wey bilive get rilashons wey en husband don die, make e help dem. Make e nor worry di church about dem, so dat dem go fit help di oda wimen wey dia husband don die.
17 Doz wey dey lead well, make dem pay dem well, especially doz wey dey work and tish well-well, so dat di gospel go stand. 18 Bikos God word sey, “Animal wey dey harvest korn, make una nor tie en mout.” Anybody wey dey work, suppose get en pay. 19 Make yu nor asept any words wey dem tok against any leader, unless two or three pipol bear witness sey na true. 20 Doz wey dey sin, make yu korrect dem for evribody front, so dat e go bi warnin to odas.
21 For God, Jesus Christ and di angels wey dey with us, I dey enkourage yu make yu obey all di kommand without wayo.
22 Make yu nor hurry to make pesin leader and nor rush put hand for en head, so dat yu nor go karry anoda pesin sin for yor head. Make yu keep yorsef pure.
23 Nor dey drink only wota, but make yu still drink small wine bikos of yor belle wey dey make yu sick anyhow.
24 Remember sey some pipol dey sin make evribody si am and dis dey judge dem. But e get some wey yu nor go know dia sins naw, but leta, e go kom out for publik. 25 Like dis too, pipol dey si di good work wey odas dey do and one day, di good work wey dem do for sekret, go kom out for publik.