10
God Promise
Make una ask God for rain wen rainin sizin rish, bikos na God dey give rain wey dey make evritin wey pipol plant, grow. Pipol dey go meet juju priest and doz wey dey si tumoro, but dem just dey lie and deceive dem. Some dey tok wetin dreams mean, but dem dey only deceive una and na only yuzles hope dem dey give. So many pipol dey waka anyhow like sheep wey waka lost. Dem dey trobol, bikos dem nor get who dey lead dem. God sey, “Bikos I dey vex for doz strenjas wey dey rule my pipol, I go ponish dem well-well. Judah pipol na my own and mi wey bi di God wey dey mighty go kare for dem. Dem go bi my strong shariot. Rulers, leaders and kommanders go kom from Judah and some go rule my pipol. Judah pipol go win and mash dia enemies for portor-portor. Wen dem go fight, dem go win dia enemies, bikos mi God dey with dem.
“I go make Judah pipol strong and I go save Israel pipol. I go sorry for dem kon bring dem back to dia land. Dem go bi like pipol wey I neva rijet before. Na mi bi Oga dia God and I go ansa all dia prayers. Israel pipol go bi like strong sojas and dem go happy like pipol wey drink wine. Dia shidren go remember as dem take win kon happy, bikos of wetin God don do. I go koll and gada my pipol togeda. I go save dem and dem go many pass as dem bi before. Even doh I skata dem go oda nashons, dem go remember mi for anywhere wey dem dey. Dem with dia shidren wey survive, go kom back to Israel land. 10 I go bring dem kom back from Egypt and Assyria kon make dem stay dia own kountry again. I go still make dem stay for Gilead and Lebanon and dia pipol go full di whole land. 11 Dem go cross rof river and I go stop di wave and Nile River go dry finish. Assyria wey bin dey karry body up, go honbol demsef and Egypt wey dey strong, nor go get pawa again. 12 I go make my pipol strong and dem go woship and obey mi.”
Mi, Oga God, don tok.