5
Di Book Wey Dey Fly
I look up again and I kon si one book dey fly for di sky. Den di angel ask mi, “Wetin yu dey si?” I ansa, “Na book wey dey fly and e long rish thirty fit kon wide rish fifteen fit.” Den di angel tell mi, “Dem rite all di curse wey dey di land inside di book. For one side for di book, dem rite put sey, ‘Anybody wey dey tif, dem go drive am komot di land,’ and for di oda side, wetin dem rite put na, ‘Anybody wey dey lie, dem go drive am komot di land too.’ ” Oga God sey, “Doz wey dey tif and lie, I go send dis curse go meet dem for dia house and di curse go stay and distroy dem finish.”
Di Woman Wey Dey Inside Basket
Leta, di angel kon tell mi again, “Make yu look! Anoda tin dey kom!” So I ask, “Wetin bi dat?” E ansa, “Na basket and na di whole land sin full inside.” Den dem open di heavy kover wey dem take kover di basket and as I look am, na one woman sidan for inside! Den di angel sey, “Dis woman name na, ‘Wikedness.’ ” So e push di woman enter di basket back kon kover am. I look up again kon si two wimen dey fly kom meet us and dem get strong feada like bird own. Dem pick di basket kon fly go with am. 10 So I ask di angel, “Di basket and di woman wey dey inside, na where dem dey karry dem go?” 11 Di angel ansa, “Na Babilon and dem go build temple for am for der. Wen dem don build di temple finish, dem go put di basket for der.”