2
Fake Tishas
As fake profets dey among di pipol before, na so fake tishas go dey among una too. Dis fake tishas go tish lie-lie tins wey fit distroy pesin and dem go sey dem nor know di Masta. Like dis, dem go distroy demsef. Many pipol go follow dem live dia yeye life. Bikos of dis fake tishas, pipol go tok bad about di trut, and dis tishas go deceive una with dia wayo. God don kondemn dem tey-tey and Christ wey go distroy dem, nor dey sleep. God nor sorry for di angels wey sin, E trow dem for hell and tie dem for darkness until di day wen E go judge di world. God nor sorry for di world wey dey before and E distroy am with wota, but save Noah wey prish make pipol do wetin good for God eye and di seven pipol wey dey with am. E still turn Sodom and Gomorrah to ashes wen E distroy dem, den E use dem as ezample for di pipol wey dey live bad life, but E save Lot wey nor like wiked pipol life, (bikos di time wey Lot dey dat town, e vex for di bad tins wey di pipol dey do). If God do all dis tins, den E know how to save en pipol from trobol kon tie wiked pipol keep, so dat E go ponish dem wen E go judge di world. 10 Dis na di pipol wey dey do wetin dia body wont and dem nor dey respet pipol wey get authority.
Dem nor dey fear; dem dey karry body up; dey tok bad about tins wey God kreate for heaven, 11 even angels wey get pawa pass dem, nor dey tok about dis tins for God present. 12 But dis men bi like animal wey nor dey tink; animals wey pipol fit kill anyhow and dem just dey do as dem like. Dis pipol dey tok anyhow and na distroshon go end dia life. 13 Dem go sofa for dis tins wey dem dey do, bikos dem feel sey dem fit do anytin wey dia body wont for day time and wen ever dem follow una chop, dem dey kause trobol among una. 14 Wetin dem like pass, na to sleep with who dem nor marry; dem nor dey taya to sin and dem dey draw doz wey dia faith nor strong, follow body. Dem don train dia mind to get long-trot and God don curse dem. 15 Since dem komot from di rite way, dem don miss road, bikos dem dey follow Balaam, Beor pikin, wey love bad tins! 16 As God dey korrect Balaam for en sin (donkey wey nor suppose tok kon tok to di profet, so dat e go stop di bad tins wey e dey do).
17 Dis pipol bi like river wey nor get wota, dem bi like kloud wey breeze dey blow anyhow and na dem God dey keep di place wey dark pass, dey wait. 18 Dem dey use dia big-big grammar wey nor mean anytin, take deceive pipol wey just dey won komot hand for bad tins. 19 Even doh dis fake tishas dey promise dis pipol sey, dem go dey free, di fake tisha na slave dem bi to sin. Bikos pesin na slave to anytin wey masta am. 20 Afta dem don free from sin thru awa Oga God and Savior Jesus Christ and dem kon let sin masta dem again, dia kondishon for di end, go worse pass as e bi before. 21 Bikos e for betta sey, dem nor know God at-all, dan sey afta dem don know am, dem kon turn back from di kommandment wey God give dem. 22 Na dem bi ezample for dis word wey pipol tok, “Dog dey go back go chop en vomit,” and “Pig wey dem don wosh en body, go still go liedan for portor-portor.”