34
Moses Die
1 Den Moses komot from Moab Wildaness kon go Mount Nebo until e rish on-top Pisgah mountin, opposite Jeriko. God show am all di land from Gilead go rish Dan, 2 plus Naftali Efraim, Manasseh and all Judah land go rish di sea for far. 3 God show am Negev and di valley for Jeriko; di town wey get palm tree and Zoar land. 4 Den God tell Moses, “Dis na di land wey I promise Abraham, Isaak and Jakob wen I sey, ‘I go give dis land to yor shidren-shidren.’ I don let yu si am, but yu nor go cross enter.”
5 So Moses wey bi God savant kon die for Moab land, just as God bin tok. 6 God beri am for Moab land near Bet-Peor, but kon rish today, nobody fit sey, “Na here or na der God beri Moses put.” 7 Moses na one hundred and twenty years wen e die, but en eye still klear and e still strong like yong boy. 8 Israel pipol mourn for Moses for thirty days inside Moab wildaness; den dem kon stop to mourn for Moses.
Joshua Take-ova
9 Naw, Nun pikin, Joshua get wisdom well-well, bikos Moses don pray for am. So Israel pipol dey obey Joshua and dey do God kommand wey E give dem thru Moses.
10 E nor ever get any oda profet for Israel wey bi like Moses, wey si God face-to-face. 11 God send am go do many signs and wonders for di king for Egypt, en ofisas and for di whole land. 12 E nor get any oda profet wey don fit do all di strong and mighty tins wey Moses do for Israel pipol present.