6
Make Wi Support Each Oda
My brodas and sistas, if una si pesin dey sin, make una wey dey spiritual, koll am back. But make una wosh unasef, so dat una nor go fall inside temptashon too. Make una help karry each oda load and if una do like dis, una dey obey Christ. Bikos if anybody tink sey, en too big wen e nor bi anytin, e dey deceive ensef. Instead of una to dey kompare unasef with anoda pesin, make una shek unasef, den una go fit tok about unasef. Bikos each pesin go karry en own load by ensef.
Di pesin wey dem dey tish God word, must share di good tins wey e get with di pesin wey dey tish am. Make una nor let anybody deceive una. Nobody go fit deceive God. Anytin wey pesin plant, naim e go reap, bikos di pesin wey dey live akordin to en flesh, go reap bad tins, but di pesin wey dey live akordin to God Spirit, go reap life wey nor dey end. So make to do good, nor taya us, bikos wen time rish, wi go gain am. 10 So anytime wey wi get shance, make wi dey do good, especially to pipol wey bi God shidren.
Paul Last Kommand And Prayer
11 Make una si as di word wey I take my hand rite give una, big rish!
12 Pipol wey won show sey dem good, dey try to force una to sekonsaiz. Dem dey do so, so dat dem nor go sofa, bikos of Christ cross. 13 Pipol wey sekonsaiz nor dey obey di law, but dem wont make una sekonsaiz, so dat dem go fit use una take boast. 14 I nor go boast about anytin escept for di sofa wey awa Oga God Jesus Christ sofa and bikos of dat sofa, di world nor mean anytin to mi and I don die to di world too. 15 Weda pesin sekonsaiz or not, e nor mean anytin, di only tin wey matter bi sey, una don turn to new pesin. 16 Una wey dey obey dis rule wey I dey give so, make peace and mesi dey with una and all God pipol.
17 From naw go, make nobody worry mi, bikos I get Jesus Christ mark for my body.
18 My brodas and sistas, make awa Oga God Jesus Christ grace dey with una spirit. Amen!