14
Hosea Tok To Israel Pipol
Israel pipol, make una turn back
kom meet di Oga una God,
bikos una sin don make una fall.
Make una turn kom meet God and pray to am sey:
“Make Yu forgive us awa sin
kon asept awa prayers,
so dat wi go praiz Yu.
Assyria pipol nor go fit save us
and awa shariot nor go fit protet us.
Wi nor go ever tell juju again sey,
‘Na yu bi awa god!’
Na Yu God dey save doz
wey nor get papa and mama again.”
So God ansa,
“I go bring my pipol kom back to mi.
I go love dem with all my heart
and I nor go vex for dem again.
I go bi like dew to Israel pipol.
Dem go shine like lily flower
kon strong for groun like Lebanon tree.
Dia branches go spread
kom out like fine olive tree.
Dem go get good smell like Lebanon trees.
I go protet dem again.
Dem go prosper like betta korn wey dem plant
kon fine like grape gardin.
Pipol go know dem like di way dem
know Lebanon wine.
Efraim pipol nor go get anytin to do with juju again.
I go ansa dia prayers kon kare for dem.
I go give dem house like betta green fig tree
and na mi go bless dem.”
Konklusion
Make doz wey dey wise,
undastand dis tins.
Make doz wey get sense,
listin well-well.
God ways dey true and e dey rite too
and pipol wey dey raitious, dey follow am
as dem dey live dia life.
But doz wey dey sin,
go stagga fall.