25
Bildad Still Tok 
  1 Bildad kon sey:   
 2 “Na God get pawa pass.  
E keep en kingdom wey dey heaven for peace.   
 3 Anybody fit kount di angels?  
Abi e get where God lite nor dey shine rish?   
 4 Anybody fit dey klean before God?  
How yu wey woman born won take dey pure?   
 5 For God eye, even di moon nor brite  
and di stars nor shine rish.   
 6 Tok-less of human being wey just bi like worm and magot!  
Wetin dia life mean to God?”