26
Job Ansa Bildad 
  1 Job ansa:   
 2 “Si how yu don help pipol wey nor get pawa.  
Yu don save pipol wey nor get strent at-all!   
 3 Yu dey give dem good advise kon share wetin yu know with fools,  
like mi!   
 4 Who yu feel sey go hear all wetin yu dey tok?  
Na wish spirit make yu dey tok like dis?   
God Great 
  5 “Dead body dey shake with fear for dia grave.  
Evritin wey dey inside wota dey shake too.   
 6 Where dead body dey stay just dey open before God;  
nor-tin fit kover am from en eye.   
 7 God spread di sky for nort  
kon hang di eart for empty space.   
 8 Na God put wota for di kloud  
and E nor dey let rain fall from di kloud with force.   
 9 Na-im use di kloud  
take kover di moon.   
 10 E kreate di sky wen E separate di wota  
and divide lite from darkness.   
 11 As God tok, di pila wey hold di sky  
kon dey shake with fear.   
 12 Na en pawa E use take silent di sea.  
Na en wisdom E take distroy Rahab wey bi di wota juju.   
 13 Wen E breath, di sky dey klear.  
Na en hand E take distroy di big snake.   
 14 But all dis na small tin kompare to di pawa wey E get.  
Na small wi don hear.  
Who go fit really undastand how God strong and great rish?”