Malakai
Introdushon
Haggai and Zekaraya profesy enkourage Zerubabel di govnor and Joshua di high priest, afta Israel pipol return to Jerusalem from esile. Dem komplete di new temple in 516 BC. Dis temple show sey di pipol won live in peace and woship God with all dia heart. Di main message for di book bi sey, if Israel pipol fulfil God will, dem go bi lite for di whole world.
But as years dey pass, di pipol nor kon dey do wetin dem suppose do. For more dan fifty years, koroupshon and wikedness kon full di land. Malakai (wey mean “my messenja”) kon tell Israel pipol make dem honor God as dem dey woship and tok with one anoda. Dis attitude go make di world know sey na God bi dia great King. Malakai esplain en message well, so di pipol kon turn from dia sin and kom to God. Di book end with God promise, wen E sey E go send anoda profet like Elijah kom, before dat great day wey E go judge dis eart.
1
God Love Israel
Dis na di message wey God give Malakai about Israel pipol.
God sey, “I don show how I love una.” But una dey ask, “How Yu take show us love?”
God kon ansa dem, “Esau and Jakob na brodas, but I choose una grand-papa, Jakob kon rijet Esau, en broda. I distroy Esau hill kountry kon turn dia land to where dem dey trowey dirty put and naw, na wild animals dey stay der.”
Esau shidren-shidren wey bi Edom fit sey, “Even doh awa towns don skata finish, wi go build dem again.” But God wey dey lead heaven sojas ansa, “Make una go ribuild dem, but I go still skata dem and pipol go koll una kountry, ‘Di Land wey Wikedness Full’ and dem go koll una pipol, ‘Di pipol wey Oga God go always dey vex with.’ ” Wen una si all dis tins dey happen, una go sey, “God pawa big well-well both for Israel land and for evriwhere for di world!”
Oga God ask di priests, “Pikin dey honor en papa and savant dey respet en masta, but wetin make una nor dey honor mi wey bi una papa? If I bi una masta, why una nor dey respet mi? Una nor dey respet mi, yet una dey ask, ‘How wi nor take dey respet Yu?’ Dis na how una nor take dey respet mi: una dey offa yuzles food for my altar, yet una still dey ask, ‘How wi nor take dey honor yor name?’ I go tell una. Una sakrifice show sey una nor dey respet my altar at-all. Una tink sey e nor dey bad to offa animal wey blind and dey sick as sakrifice to mi? Make una try give dat kind animal to una govnor, weda e go happy or give una anytin wey una ask from am. So, make una beg God, so dat E go favor una. But with dis kind sakrifice wey una dey bring, how E won take ansa una prayers?”
10 God sey, “I wish sey one of una go klose di temple door, so dat una nor go dey burn yuzles fire for my altar. I nor dey happy with una and I nor go asept di sakrifice wey una dey bring kom give mi.”
11 God sey, “From east go rish west, pipol go honor my name for evriwhere. Dem go burn betta incense and offa betta sakrifice give mi, bikos my name go dey great among all di nashons. 12 But una nor dey respet mi, bikos una sey e dey okay to spoil God altar, so una dey give mi sakrifice wey unasef nor go asept. 13 Una sey, ‘Si! E too hard to serve God!’ So una nor gri obey my kommand again. Naw, make una tink am sef, e good as una dey bring animal wey una tif; di ones wey dia leg break or wey dey sick, kom give mi as sakrifice? Una tink sey I go asept am from una? 14 Curse dey di pesin head wey dey play wayo and offa yuzles animal, wen e bi sey e get many betta animals wey e promise sey e go give mi! I bi strong king and all di nashon dey fear mi.”