150
Praiz God
1 Make wi Praiz God!
Make wi praiz am for en temple;
make wi praiz am for di sky wey dey tok about en great pawa!
2 Make wi praiz am for di big-big tins wey E dey do;
make wi praiz am, bikos en greatness good pass evritin!
3 Make wi praiz am with trumpet sound;
make wi praiz am with jita and harp!
4 Make wi dance praiz am with sheke-sheke;
make wi praiz am with jita and flute!
5 Make wi dey nak cymbals togeda as wi dey praiz am.
Yes! Make wi praiz am with loud cymbals.
6 Make evritin wey dey alive, sing praiz God.
Make evribody praiz God!