15
Di sevent Year
For di end of evry seven year, make una kancel di debt wey anybody dey owe una. Dis na how una go dey do am. Evribody must kancel di debt wey dia fellow Israel broda dey hold dem. Dem must nor sey make dia neighbour or rilative pay dem back, bikos God time to free pipol, don rish. Dis freedom from debt na for only una brodas nor bi for di strenjas. Make poor pesin nor dey among una, bikos di Oga una God go really bless una for di land wey E dey give una as una own forever. Una go receive dis blessing if una really obey dis kommand wey I dey give una. Bikos di Oga una God go bless una just as E promise; una go give to many kountries, but una nor go borrow from any one. Una go rule many kountries, but no kountry go rule una.
Free Spirit
But if anybody dey poor for Israel wen una rish di land wey di Oga una God dey give una, make una nor do strong head for am at-all. Una must make sure sey una dey good to am kon gi-am anytin wey e nid. Make una dey kareful, if not wiked tins go full una mind, den una nor go give pesin money, bikos di seven years don dey near. If una nor gri give di pesin money and di pesin kon kry give God, dat mean sey una don kommit sin. 10 Make una dey give to poor pipol with happiness, bikos di Oga una God go bless una for evritin wey una dey do. 11 E go always get some pipol for di land wey go dey poor. Dat na why I dey kommand una to dey give with happy mind to poor pipol and odas for Israel wey nid anytin.
Slave
12 If una fellow Hibru sell ensef to bi una savant kon serve una for six years, for di sevent year, una must free di pesin. 13 Wen una dey free una savant, make una nor let dem go like dat. 14 Make una give dem betta gift with happiness from una animal and from una wine. Make una give some of di blessing wey God give una. 15 Make una remember sey una bi slave for Egypt until di Oga una God kon save una! Na dis make mi dey give una dis kommand.
16 But if una savant sey, “I nor wont go,” bikos e love una and una family and e don serve una well. 17 For dat kind kase, make una take sharp iron take press en ear join di door, den e go bi una savant forever. Una go do like dis both for una man and woman savant.
18 Make una nor si am as big lost wen una free una savants. Make una remember sey, di work wey dem don work for una for six years, if una sey make una hire pesin make e do am, una go pay am times two. So di Oga una God go bless una for dis tin wey una do.
Give God Di Best
19 All di first male wey una animal born, una go give dem to God. Make una nor use dem take go klear una field and make una nor shear dem at-all. 20 Instead, for evry year, una and una family go chop dem for di Oga una God present, for di place wey E choose. 21 But if di first pikin for di animal get problem like sey e nor fit waka or e blind or if any oda tin dey happen to am, make una nor sakrifice am give di Oga una God. 22 Instead, make una use am take kook for una family for house. Anybody, weda e dey klean or e nor klean, fit chop from am, just as anybody fit chop deer or gazelle. 23 But make una nor chop blood. Una must pour di blood for groun like wota.