16
Di Passova
Just to honor di Oga una God, make una dey celebrate di Passova evry year for Abib mont, bikos dat na di mont wey di Oga una God take karry una komot from Egypt for nite. Una Passova sakrifice go bi from di animal wey una get and una must sakrifice am give di Oga una God for di place wey E sey make una woship am; where E choose make dem honor en name. Make una chop am with bread wey dem nor make with yist and una go chop dis bread for seven days, just as e bi wen una rush dey komot from Egypt. Make una chop dis bread (bikos na-im una chop wen una dey sofa), so dat as long as una dey alive, una go remember di day wey una komot from Egypt. Make dem nor si yist for anybody house for dis land thru-out di seven days. And wen una sakrifice di Passova lamb for evening for di first day, make una nor let any meat remain till morning.
Una nor go just sakrifice di Passova lamb for any town wey God dey give una. Una go only sakrifice am for di place wey dem for dey woship God; di place wey di Oga una God choose sey dem go for honor en name. As di sun dey go down, una go sakrifice am der for evening to take celebrate and remember wen una komot from Egypt. Make una roast and chop di lamb for di place wey una Oga God choose. Den, di next day, una fit go back to una house. For di next six days, make una nor chop any bread wey dem make with yist. Una go make di sevent day anoda holy day to honor di Oga una God and make nobody work for dat day.
Week Feast
From di day wey una bigin harvest, make una kount seven weeks. 10 Den make una celebrate Harvest Feast to honor di Oga una God. Make una gi-am ofrin from una mind, akordin to how E bless una rish. 11 Dis na time to celebrate before di Oga una God for di place wey dem for dey woship am; di place wey E choose sey make dem honor en name. Make una celebrate with una shidren, all una savants, Levi pipol for una town, strenjas, shidren wey nor get papa and mama again and wimen wey dia husband don die wey dey stay with una. 12 Make una remember sey na slave una bi for Egypt before, so make una obey all dis kommand with kare.
Shelta Feast
13 Make una celebrate Shelta Feast for seven days for di time wen una dey harvest una plant and grapes. 14 Wen una dey celebrate dis feast, make una happy with una shidren, all una savants, Levi pipol for una town, strenjas, shidren wey nor get papa and mama again and wimen wey dia husband don die, wey dey stay with una. 15 Una must celebrate dis feast for seven days to honor di Oga una God for di place wey E choose, bikos na en bless una well-well kon make all una work, prosper. Dis feast go bi time for evribody to happy.
16 For evry year, evry man for Israel go dey celebrate dis three feast: Bread wey nor get yist, Harvest Feast and Shelta Feast. For each feast, evribody must karry gift kom give di Oga una God for di place wey E choose. 17 Evribody must give God as dem fit do rish and na akordin to how di Oga God bless dem rish.
Betta Judgement
18 For all di towns wey di Oga una God dey give una, make una pick doz wey fit judge from each tribe for Israel. Di judge dem must judge di pipol well. 19 Make una nor judge anyhow or judge wetin una nor know. Make di judge dem nor take bribe from pipol, bikos bribe dey blind wise pesin eye kon spoil betta pipol mind. 20 Make una judge well, so dat una go stay long for di land wey di Oga una God dey give una.
Juju House
21 Apart from di altar wey una build for di Oga wey bi una God, make una nor ever use wood take build house for Asherah juju. 22 Make una nor ever build juju house kon woship dem, bikos di Oga una God nor like all dat kind tin.