20
Law About War
Wen una go fight una enemies and una si dia horse and dia sojas wey strong pass una own, make una nor fear. Di Oga una God wey bring una kom out from Egypt, dey with una! Wen una dey ready for war, make di priest kom front kon tok to di sojas. E go tell dem, “Israel men, make una listin to mi! Today, as una dey go fight una enemies, make una nor fear at-all! Make una heart nor fail una or una kon dey shake for dia front like pikin wey nor well. Bikos di Oga una God dey go with una! E go fight una enemies for una kon make una win di war!”
Den di soja oga go tok to di sojas sey, “E get anybody for here wey just build new house and e neva dedikate am? If na so, den yu fit go house, bikos dem fit kill yu for war and anoda pesin go dedikate yor house. E get anybody for here wey just plant vineyard and neva chop anytin from am? If na so, yu fit go house, bikos dem fit kill yu for war and anoda pesin go chop di first fruit for yor harvest. E get anybody for here wey just engage woman, but e neva marry am? If na so, yu fit go house go marry, bikos dem fit kill yu for war and anoda pesin go marry di woman.” Den di soja oga go sey, “E get anybody among us wey dey fear or en heart dey shake? If na so, yu fit go house before yu go make anoda pesin, fear too.” Wen di oga don tok to dia sojas finish, dem go choose pesin wey go dey kommand each group.
10 As una near any town wey una won attack, make una first try to make peace with en pipol. 11 If dem agri with una kon open di gate for una, den all di pipol for dia go serve una as una savants. 12 But if dem nor gri open di gate for una and dem dey ready to fight, una must attack dat town. 13 Wen di Oga una God don give dat town to una, make una use una swod take kill all di men, yong boys or boy pikin for dat town. 14 But una fit take all di wimen, shidren, animals and oda tins wey una fit take. Make una enjoy all di tins wey una take from una enemies land wey God dey give una. 15 But dis kommand na for only di towns wey dey far-far, nor bi for di towns inside di kountries wey una won stay.
Law About War With Kanaan
16 For doz towns and kountries wey di Oga una God dey give una as where una go stay, make una distroy evritin wey dey inside dem. 17 Hit, Amor, Kanaan, Periz, Hiv and Jebus pipol, una must distroy dem finish, just as di Oga una God kommand. 18 If una distroy dem finish, di pipol for di land nor go dey to tish una how to serve and woship dia own gods and juju wey go make una sin against di Oga una God.
19 Wen una dey attack any town and di war nor dey end, make una nor use una axe take kut di trees. Una fit chop dia fruit, but make una nor kut dem. Na di trees bi una enemies wey make una won attack dem? 20 Di only tree wey una fit kut, na di ones wey nor good for food, den kon use dem take make tins wey una nid to take attack di enemies town until di town go fall.