21
Law About Kilin
Wen una dey di land wey di Oga una God dey give una, una fit si pesin wey dem kill for di field and una nor know who kill-am. For dat kind matter, una eldas and judge go measure from where dem for kill di pesin go rish di town wey dey near der. Di eldas for di town wey dey near where dem for kill di pesin, go take one small melu wey dem neva tish anytin or use work at-all. Dem go escort am go di valley wey dem neva plant or klear before and wey wota dey rush pass. Wen dem rish di valley, dem go break di melu neck for der. Den di Levi priest go kon front (bikos di Oga una God don choose dem to serve am and to bless una with en name). Na dem go dey judge both good and bad kase for di town. Di eldas for dat town must wosh dia hand on-top di small melu wey dem don break en neck. Den dem go sey, “Awa hand and leg nor dey for dis pesin deat and wi nor si am wen dem dey kill-am. So God go forgive en pipol Israel wey E save and E nor go ponish dem sey na dem kill pesin wey nor do anytin.” Den di sin nor go dey dia head at-all. If una follow dis kommand, una go do wetin dey rite for God eye and una go dey save from dis sin.
Law About Wife
10 Wen una dey go fight una enemies and di Oga una God make una win kon katch some of dem as una prisona 11 and among di pipol wey una take so, una si fine woman for inside wey una like marry, 12 una fit karry am go una house. Di woman must shave en head, kut en finger 13 burn di klot wey e wear wen dem katch am, den kon stay una house. E go take one mont take mourn for en papa and mama wey die. Den una fit marry am as una wife. 14 But if una marry am and e nor dey do as una wont make e do, make una let am go free. Since una force and sleep with di woman, una nor go fit trit am like slave kon sell am.
Law About Shidren
15 If man get two wife and e love won pass di oda, den di two wife born boy pikin, If di first-born na from di wife wey e nor love, 16 wen di man dey divide en propaty, make e nor give di biggest part to di yonga one wey e love en mama, bikos nor bi en dem first-born. 17 E must give di first pikin wetin bi en own, even doh e nor love di mama. E must gi-am times two of wetin e give di sekond pikin, bikos na di first son bi en papa pawa and honor.
18 If pesin get sturbon son wey nor dey listin to en papa and mama even doh dem ponish am, 19 make en papa and mama seize am kom meet di eldas for di town gate. 20 Dem go tell di eldas for di town sey, “Awa pikin too sturbon and e nor dey hear word, e dey chop and drink anyhow.” 21 Den, all di men for di town go stone di pikin die. Like dis, una go remove all di wiked pipol wey dey among una and wen evribody for Israel hear wetin happen, fear go katch dem.
Pesin Wey Dem Hang
22 If pesin do wetin go make dem kill-am and dem hang am for tree make e die, 23 make di body nor dey di tree till di next day. Na dat same day una go beri di body, bikos en body wey dem hang, na curse for God eye. Make una nor dirty di land wey di Oga una God dey give una.