23
Publik Woship
If anybody wound or dem kut en private part komot, make una nor let am kom God present.
Make una nor let pesin wey nor know en papa kom God present; even to en tent generashon, make nor of dem enter where God dey.
Make no Ammon or Moab pesin enter God present; even to dia tent generashon, make nor of dem enter where God dey. Dis pipol nor welkom una with food and wota wen una kom out from Egypt. Instead dem hire Balaam wey en papa bi Beor from Petor wey dey Aram Naharaim sey make e curse una. But di Oga una God nor gri listin to Balaam. Di curse wey Balaam suppose curse una, e turn am to blessing bikos di Oga una God love una. As long as una dey dis life, make una nor ever pray for peace or betta tin for dem.
Make una nor hate Edom or Egypt pipol, bikos Edom pipol na una brodas and una stay as strenjas for Egypt. Di third generashon for Edom and Egypt pipol fit enter God present.
To Dey Klean
Wen una dey go fight una enemies, make una guide unasef against anytin wey nor klean. 10 If anybody dey among una wey nor dey klean, bikos of wetin e do with en body for nite, e must komot di kamp and e nor go enter for sometaim. 11 Wen evening don rish, make e wosh ensef with wota, den wen sun don go down, e fit enter di kamp again.
12 Una must get somewhere outside di kamp where pipol go for dey piss or shit. 13 Una must get shovel among evry oda tin wey una get, so dat wen una shit for outside di kamp, una go dig groun with di shovel den pour di shit for der kon kover am. 14 Bikos di Oga una God dey waka for di kamp to diliver una kon kill una enemies. So una kamp must dey holy, so dat E nor go si anytin wey go make am turn from una.
How To Trit Slave
15 Any slave wey run leave en masta kom meet una, una must nor take am go back. 16 Make dem stay with una for any town wey dem choose and make una nor opress dem.
Ashawo Among Una
17 Make nobody for Israel, weda na man or woman, turn ashawo for di temple. 18 Wen una dey bring una vow ofrin, make una nor bring any ashawo pesin ofrin kon give di Oga una God, weda na man or woman, bikos dat kind tin dey make di Oga una God vex.
Respet Odas Propaty
19 If una give money, food or any oda tin to una fellow brodas for Israel, make una nor put intrest at-all. 20 Una fit borrow with intrest give strenja, but nor bi to una own fellow Israel broda and if una keep dis kommand, di Oga una God go bless una for evritin wey una dey do for di land wey una go soon take as una own.
21 Wen una make promise give di Oga una God, make e nor tey before una do wetin una promise, if not, God go hold una sey una don sin. 22 But e nor go bi sin, if pesin nor make promise or vow at-all. 23 Anytin wey una promise, una must dey kareful sey una do am. And di promise wey una make to di Oga una God must kom from una free mind.
24 If una enter una neighbour vineyard, una fit chop as many grapes as una wont, but make una nor take any one komot from di vineyard. 25 And wen una enter una neighbour grain field, una fit plok di grain head with una hand, but make una nor kut am with knife.