24
To Marry Again
Wen man marry woman and e nor like am, bikos e don si one bad karata for en body, e fit rite divorce paper give di woman, den tell am make e komot from en house. Wen di woman komot di house, e fit marry anoda man. But if di sekond husband still get problem with di same woman kon divorce am or di man die, di first husband nor go marry am again, bikos di woman nor dey klean and dis tin nor dey good for God eye. Make una nor bring problem kom di land wey di Oga una God dey give una.
Make una nor put man wey just marry among di sojas or gi-am any oda work. E must dey free to spend one year for en house, so dat di wife go dey happy.
Wen una borrow pesin money, make una nor take en grindin stone as shorti, bikos dat na di only tin wey di family take dey chop.
If una katch pesin wey kidnap anoda Israel pesin kon dey trit am like slave or sell am, di pesin wey kidnap anoda pesin, must die. Like dis, una go remove bad-bad tins from among una.
Respet Human Being
As una dey do as di priest sey make una do, make una dey kareful about bad diziz. Make una obey all di kommand wey I don give una. Make una remember wetin di Oga una God do to Miriam as una dey kom out from Egypt.
10 If una borrow anytin give una neighbour, make una nor enter en house kon take wetin e use as shorti. 11 Una go wait for outside den e go enter en house go bring am for una. 12 If una neighbour na poor man and e kon give una en klot as shorti for di money wey e borrow, make una nor keep dat klot till di next day. 13 Make una take di klot go give who get am wen evening rish, so dat en body go dey warm for nite and e go bless una, den di Oga una God go si una as pipol wey dey do good.
14 Make una nor opress poor pipol and doz wey dey work for una; weda dem bi Israel pipol or strenjas wey dey stay with una. 15 Una must pay dem for dia work evriday wen evening rish, bikos dem poor and dey wait dat money. If una nor pay dem, dem fit kry give God and di sin go dey una head.
16 Make una nor kill papa or mama, bikos of di sin wey dia shidren kommit, or kill shidren bikos of wetin dia papa and mama do; if una go kill pesin at-all, e must bi for en own sin.
17 Una must judge well for di strenjas wey dey with una; doz wey nor get papa and mama and woman wey en husband don die. Make una nor ever take dia klot as shorti for debt. 18 Make una always remember sey una bi slave for Egypt, before di Oga una God kon save una. Na dis make mi give una dis kommand.
19 Wen una harvest una plant kon leave some for di farm, make una nor go back go gada dem. Make una leave doz ones for strenjas; doz wey nor get papa and mama and doz wey dia husband don die, den di Oga una God go bless una for all di work wey una dey do. 20 Wen una dey plok olive fruit from en tree, di ones wey remain bilong to doz wey bi strenjas; wey nor get papa and mama and doz wey dia husband don die. 21 Wen una dey gada grape for una vineyard, make una nor go back again go gada wetin remain; bikos doz ones na for doz wey bi strenjas; wey nor get papa and mama and doz wey dia husband don die. 22 Make una remember sey una bi slave for Egypt before and na dis make mi dey kommand una to do all dis tins.