25
If two pipol kworel kon go kourt and di judge sey one dey rite and di oda one dey wrong. If di judge sey make dem flog di one wey dey wrong, di judge go kommand am make e liedan for en front make dem flog am. But make una nor flog pesin pass forty times, bikos if una flog am pass forty times, den una don disgrace am bi dat.
Make una nor stop una melu make e nor chop wen e dey harvest for una.
Respet Odas
If two brodas dey stay togeda and one die and e nor get boy pikin, di wife wey en husband don die must nor marry anoda man wey nor dey dat family. Instead, di woman husband broda go marry am kon kare for am. Den di first boy wey di woman go born, go ansa dat one wey don die name, so dat dem nor go forget di broda name for Israel.
But if di broda sey e nor go fit marry en dead broda wife, den make di woman go ripot to di eldas for di town gate sey, “My husband broda sey e nor fit keep en broda name for Israel; so e nor gri marry mi!” Den di eldas for di town go koll and tok to am. If e still sey, “I nor won marry am,” den di woman go waka go meet am for di eldas front kon remove en sandal from e leg den spit for en face. Den di woman go sey, “Make dis kind tin happen to any man wey nor gri keep en broda name for Israel!” 10 Den dem go dey koll en family, “Family wey dem pul di man sandal komot en leg.”
11 If two men dey fight with hand and one wife kon join help en husband attack di oda, den di woman use en hand take hold di oda man private part, 12 una go kut di woman hand komot and make una nor sorry for am.
13 Wen una dey measure tins, una must measure well 14 and make una get only one kontaina for una house to take measure. 15 Make una always dey use di rite skale take measure, so dat una go get long life for di land wey di Oga una God dey give una. 16 Doz wey dey measure with fake skale, dey sin against di Oga una God.
Amalek Pipol
17 Make una nor ever forget wetin Amalek pipol do una wen una just dey kom out from Egypt. 18 Dat time, as una taya and dey hongry, bikos dem nor dey fear God, dem attack una kon kill doz wey dey stagga dey kom for back. 19 So wen di Oga una God don give una rest from all una enemies for di land wey E promise una, una must distroy Amalek pipol finish for dis world and nor of dem go remain.