26
First Fruit
Wen una enter di land wey di Oga una God won give una as una own and una don win evribody for der, make una put some of di first fruits and plant wey una harvest inside one basket kon bring dem kom di place wey God don choose for woship and where dem go for honor en name. Make una go meet di priest wey dey der for dat time kon tell am, “With dis gift, wi won make di Oga awa God know sey wi don enter di land wey E promise awa grand-grand papa sey E go give us.” Den di priest go take di basket from una hand kon go put am for di Oga una God altar. Den una go sey, “Awa papa Jakob waka from Aramean go stay for Egypt as strenja. En family for dat time, nor many, but wen dem dey komot Egypt, dem kon plenty and dem bi strong pipol naw. Wen Egypt pipol dey opress and ponish us as dia slaves, wi kry to God wey bi awa grand-grand papa God. E hear awa kry kon si as wi dey sofa and as Egypt pipol dey ponish and trit us. So God take us komot from Egypt with en pawa, en strong hand and all en pawaful signs and wonders. Den E bring us kom dis place kon give us dis land wey full with milk and honey! 10 And naw, awa God, wi don bring di first fruit, plants and animal wey Yu give us for dis groun.” Make una put evritin for di Oga una God present, den bow woship am. 11 Afta una don woship am, una go celebrate bikos of all di good tins wey di Oga una God don give una and una family, di Levi and di strenjas wey dey stay among una.
Third Year Tithe
12 Evry three years, una must offa special tithe for una plants. For dat year, una must give una tithe to Levi pipol, di strenjas, doz wey nor get papa and mama and wimen wey dia husband don die, so dat dem go dey si food chop for di town. 13 Den for di Oga una God present, una go sey, “Wi don take di holy gift from awa house kon gi-am to Levi pipol, di strenjas, doz wey nor get papa and mama and wimen wey dia husband don die, just as Yu kommand us. Wi neva forget and wi don do evritin wey Yu kommand. 14 Even wen wi dey mourn, wi nor chop any one; wen wi nor dey klean at-all, wi nor tosh am and wi neva offa any of am to dead body. Wi don obey di Oga awa God and wi don do evritin wey Yu kommand us. 15 Naw, make Yu look down from yor holy house for heaven kon bless Israel wey bi yor pipol and di land wey Yu promise awa grand-grand papa sey, Yu go give us. Di land wey full with milk and honey.”
God Pipol
16 Today, di Oga una God don kommand una to obey all en laws and rules. So make una dey sure sey una dey obey dem with all una heart. 17 Una don tok today sey na di Oga bi una God. And una don promise to do wetin E tok and obey en kommand, laws, rules and to do evritin wey E tell una. 18 Today, God don sey una bi en pipol, en betta gift wey E value well-well, just as E promise, so una must obey en kommand. 19 If una obey am, E go karry una high pass evry oda pipol wey E kreate. Den una go get praiz, honor and evribody go dey tok good about una. Una go bi holy pipol to di Oga una God, just as E promise.