33
Moses Bless Di Pipol
Dis na di blessing wey Moses, God savant bless Israel pipol before e die:
“God kom from Mount Sinai and E show ensef to Israel pipol for Seir;
E shine kom from Mount Paran and E kom with 10,000 holy ones.
Na en rite hand E take give dem en law.
Yes! God really love en pipol;
all doz wey dey holy dey en hand.
Dem waka as E dey waka
kon do di tins wey E tish dem.
Moses give us God kommand,
di special place wey E keep for en pipol, Israel.
Na God bi king for Israel
wen all di leader among di pipol go gada go meet
kon gada all di tribe for Israel as one.”
Moses pray for Reuben tribe sey:
“Reuben tribe go live and dem nor go die,
even doh dem nor plenty.”
Moses pray for Judah tribe sey:
“My God, make Yu hear Judah pipol kry
kon bring dem togeda as one.
Make Yu give dem pawa to take fight
and win dia enemies!”
Moses pray for Levi tribe sey:
“My God, Yu don give yor Tumin and Urim
to doz wey dey fear and respet Yu.
Doz wey Yu don test for Massah
kon follow dem kworel for Meribah wotaside.
Dem tell dia papa and mama sey,
‘Wi neva si am’
and e nor do like sey e know us
or en own shidren,
bikos dem keep yor word
kon guide yor kovenant.
10 Dem go tish Jakob yor law
kon tish Israel pipol yor kommand:
dem go offa betta incense for Yu
kon burn good ofrin for yor altar.
11 Make wi bless God strent
and di work wey E don do;
bikos E kill di enemies lion,
so dat dem nor go fit raiz at-all!”
12 Moses pray for Benjamin tribe sey:
“God love Benjamin pipol and
dem dey save under am.
E dey gada dem from evry side,
so dat nor-tin go do dem.”
13 Moses pray for Josef tribe sey:
“Make God bless una land with rain
and with wota wey dey kom from under di groun.
14 Make betta-betta fruit wey dey grow
under di sun dey una land
and di fruit for di sizin go bi una own.
15 Make betta fruits kover
una hills and mountins.
16 Make good tin full una land
and na God goodness go bless dem,
bikos na-im tok from di bush wey dey burn.
Make dis blessing kom meet Josef tribe,
bikos na-im bi leader among en brodas.
17 Josef get bull strent
and wiked melu horn.
E go rule pipol kon porshu dem
rish di end for di eart.
Dis na my blessing for Efraim
and Manasseh pipol.”
18 Moses pray for Zebulun and Issakar tribe sey:
“Zebulun pipol go prosper as dem dey travel.
Make Issakar pipol prosper for dia house.
19 Dem invite strenjas kon dia mountin
kon offa di rite sakrifice for der.
Dem get dia money from di sea
and di wotaside.”
20 Moses pray for Gad tribe sey:
“God go bless una wey make en land wide!
Gad pipol bi like lion wey won tear pesin hand
or head komot from en body.
21 Gad pipol take di best land for diasef;
dem give dem di leadership.
Wen Israel pipol leaders don gada,
na Gad pipol dey first obey God kommand
and rules for Israel.”
22 Moses pray for Dan tribe sey:
“Dan pipol bi like yong lion
wey dey kom out from Bashan.”
23 Moses pray for Naftali tribe sey:
“Naftali pipol, favor go follow una
and God don bless una well-well;
make una kollect di west
and sout as una own.”
24 Moses pray for Asher tribe sey:
“Make God bless Asher pipol pass evry oda sons;
make en brodas karry am high
and Asher pipol go dey wosh dia own legs
with olive oil.
25 Una gate key go bi iron and bronze
and God go guide una forever.
26 Israel pipol, no god bi like una God.
E dey kom help una from heaven
and di sky with en wonderful pawa.
27 Na di God wey go dey forever
bi una guide and provida.
En hand wey go dey forever,
dey support una.
E drive all una enemies kon sey
make una distroy dem!
28 So Israel pipol go stay for peace,
Jakob pipol go prosper for di land
wey get food and wine
and dew go drop from heaven.
29 Israel pipol, si as una dey happy!
Who bi like una?
Una bi pipol wey God diliver,
bikos na God dey protet una
and na-im bi una swod.
Make una enemies kry before una
and una go mash dia back pass.”